22
Paul Defend Ensef
“My brodas and fada, make una hear mi as I dey defend mysef.” (Wen dem hear sey e dey tok to dem with Aramaik language, dem kon kwayet well-well.) Den Paul sey, “I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today. I sofa Christians and I dey kill pipol wey dey serve God, dey tie pipol trow for prison, weda dem bi man or woman and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arrest pipol wey bilive Christ kon bring dem kom Jerusalem put for prison. As I dey go, near Damaskus, around aftanoon, one kind lite from heaven kon shine round mi. Den I fall for groun kon hear one vois wey sey, ‘Saul, Saul, why yu dey ponish mi?’ I ansa, ‘Who yu bi Oga God?’ E kon sey, ‘I bi Jesus Christ wey kom from Nazaret, wey yu dey ponish.’ Di pipol wey follow mi si di lite, but dem nor undastand di vois wey dey tok to mi. 10 So I ask am, ‘Oga God! Wetin yu wont make I do?’ God ansa, ‘Get up make yu go Damaskus; for der, dem go tell yu evritin wey God don choose sey yu go do.’ 11 Bikos of how di lite shine for my eye, I nor fit si again, so di pipol wey dey follow mi kon whole my hand go Damaskus. 12 One man wey dem dey koll Ananias, wey dey holy and dey serve God akordin to di law and di Jew pipol wey dey stay der, dey tok good about am. 13 Na di man kom meet and stand near mi sey, ‘Broda Saul, make yu bigin si again!’ So for dat same time, I look up kon si am. 14 Den e sey, ‘God wey awa grand-grand papa dem serve don already choose yu to do wetin e wont, so dat yu go take yor eye si di Raitious Pesin. So make yu hear and listin to am, 15 bikos yu go bi witness to all di pipol, about wetin yu don si and hear. 16 Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’ 17 Wen I go Jerusalem back and dey pray for di temple, I kon si vishon 18 and Jesus Christ sey, ‘Make yu komot for Jerusalem kwik-kwik, bikos dem nor go asept wetin yu dey tok about mi.’ 19 I ansa, ‘Oga God, dem diasef know sey I dey beat and trow pipol wey bilive yu put for prison. 20 And wen dem kill yor savant Stefen, I stand der support dem kon keep dia koat for dem.’ 21 But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”
Di Soja Oga God Ask Paul Kweshon
22 As e tok finish, pipol wey gada dey listin to am kon dey shaut, “Karry dis man komot! Make dem nor allow am live!” 23 As dem dey shaut dey vex pul shirt and trowey san-san, 24 di kommanding offisa kon give orda sey make dem take Paul go inside barrak. E sey make dem flog and ask Paul kweshon, so dat dem go fit know why di pipol dey shaut for Paul head like dat. 25 Wen dem don put am for groun make dem start to flog am, Paul kon ask di soja wey stand near am, “E dey rite make una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva judge en kase?” 26 Wen di soja hear dis, e go tell di kommanding offisa, “Wetin yu won do so? Dis man kom from Rome o-o.” 27 So di kommanding offisa ask Paul, “Tell mi, yu bi Roman citizin?” Paul ansa, “Yes.” 28 Di kommanding offisa kon sey, “Na big money I spend to bi Roman citizin.” Paul ansa, “But dem born mi for Rome.” 29 Den doz men wey bi won ask am kweshon kon komot and fear katch di kommanding offisa wen e know sey Paul, wey dem tie, na Roman citizin.
Paul With Di Sanhedrin
30 Di next day, bikos di kommanding offisa won know di rizin wey make di Jew pipol dey akuiz Paul, e release am kon orda di priest oga dem and di whole kansol make dem gada. So e bring Paul kon stand for dia front.