11
Fake Prishas
For wetin I won tok naw, make una bear with mi like sey I nor get sense! I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ. But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ. So, if anybody kon prish anoda Christ wey wi nor prish for una and una receive anoda spirit wey una nor receive before, or anoda gospel wey una neva hear before, dat mean sey, una don asept dem well. I nor tink sey doz “supper apostle” betta pass mi. But even doh I nor know how to tok, I know book. True-true, wi don let una know dis tins wey happen. As I honbol mysef dey do di work, na sin I kommit? I dey do am, so dat una go fit grow up and wen I prish give una, I nor kollect money. I shit di oda church dem, bikos I dey kollect money from dem, so dat I go dey work with una for free! Wen I nid anytin for di time wen I dey with una, I nor put my load for anybody head, bikos awa brodas wey Masidonia dey give mi evritin wey I nid. I nor allow mysef to bi problem for anybody and I nor go ever do am. 10 True-true, as Christ trut dey inside mi, nobody go fit stop mi for di way I dey boast for Akaia. 11 Why? Na bikos I nor love una? No! God know sey I love una! 12 And I go kontinue to do wetin I dey do, so dat doz apostles nor go get rizin to boast sey, dem dey do di same work with us. 13 Bikos dem bi fake apostles; pipol wey dey lie and pritend like sey dem bi Jesus Christ apostles. 14 E nor sopraiz us, bikos even Satan dey pritend sey en na angel wey get lite. 15 So e nor sopraiz us sey, en savants dey pritend too like sey dem bi savant wey dey do wetin good for God eye. For di end, dem go gain wetin fit di tins wey dem dey do.
Paul Sofa For Christ
16 I dey tell una again, make anybody nor tink sey I bi fool. But if una tink so, den make una asept mi as fool, so dat misef go boast small. 17 Wetin I dey boast about so, nor bi as Christ wont make I boast, instead, I dey tok like fool. 18 Since some pipol dey boast like dis world pipol, make mi mysef still boast. 19 Una sey una get sense well-well, yet una dey use happiness asept wetin fool dey tok. 20 Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow. 21 (Na shame for mi, but I must tell una sey awa heart nor strong rish to do una doz kind tins!) But anytin wey anybody fit boast about (I dey tok like fool naw o-o), misef fit boast about dat tin too. 22 Na Hibru pipol dem bi? Misef na Hibru pesin too. Dem bi Israel pipol? Mi na Israel pesin too. Na Abraham bi dia grand-grand papa? Na dat same Abraham bi my grand-grand papa too. 23 Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times. 24 Na five times Jew pipol don flog mi thirty-nine times. 25 Rome pipol don beat mi three times. Dem stone mi wons until I nearly die. Sheep wey I dey inside, don spoil for wota three times. I don float wons for wota from morning go rish di next day. 26 I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas. 27 I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body. 28 Apart from dis tins, my mind dey heavy mi evriday as I dey tink of how I go take help all di pipol wey dey God church. 29 If pesin dey weak, misef dey weak too. If dem deceive pesin enter sin, e dey pain mi well-well. 30 If I go must boast, den I go boast about di tins wey show sey I dey weak. 31 God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, wey dem go praiz forever, know sey nor bi lie I dey tok. 32 For Damaskus, King Aretas sey make di govnor put sojas for di town gate, so dat dem go arrest mi. 33 But awa pipol for der kon put mi for basket wey dem tie rope put kon drop mi small-small from di window and na so I take eskape from di man hand.