2
God Go Forgive Sinnas
So I sey I nor go kom visit una, so dat una nor go vex again. Bikos if I make una vex, who go make mi dey happy apart from una wey dey vex for mi? Na dis make mi rite dis tin give una, so dat wen I kom, I nor go kon dey vex for di pipol wey suppose make mi happy, bikos I know sey if I dey happy, una go dey happy too. Na pain for my heart I take rite dis leta give una, nor bi to make una vex, but na to let una know di kind love wey I get for una. Naw if anybody don make pesin vex, nor bi only mi e make vex, but na all of una. (I dey tok like dis bikos I nor won too vex for di pesin). Di way wey una ponish dis pesin, don rish. So make una forgive and help am, so dat e nor go luz hope and life nor go taya am. So make una let am know sey una really love am. I rite dis leta give una, so dat I go know weda una dey obey wetin I tell una. 10 Wen una forgive pesin for wetin e do, misef go forgi-am. Bikos wen I forgive (if I really nid to forgive), I do am for Christ present, bikos of una, 11 so dat Satan nor go deceive us, bikos wi know en wayo. 12 Wen I go prish di Good News for Troas, even doh Christ open door for mi, 13 my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia.
Di Apostle Ministry
14 But make wi tank God wey make us winners inside Christ. Bikos thru us, many pipol don know tins about Christ, like betta perfume wey dey smell for evriwhere. 15 Bikos wi bi like sweet smell wey Christ offa give God wey dey spread among doz wey dey save and doz wey don lost. 16 To doz wey don lost, e bi like sometin wey dey kill; but for doz wey Christ don save, e bi like smell wey dey give life. So, who go fit handle all dis tins? 17 Wi nor bi like odas wey dey do God word like sey na sometin wey dem fit sell; but bikos na God send us kom, wi dey tok di trut for en present, as Christ savant.