2
God Koll Ezekiel
God tell mi sey, “Man pikin, stand up make I tok to yu” As God dey tok to mi, en Spirit enter my body kon karry mi stand and I kon listin well to evritin wey E dey tok.
E sey, “Man pikin, I dey send yu go meet Israel pipol, bikos dem don turn from mi and still dey do bad tins, just as dia grand-grand papa do. Di pipol wey I dey send yu go meet so, dem sturbon well-well and dem nor dey respet mi. So I dey send yu go tell dem wetin mi, God wey get pawa dey tok. Weda dem listin to yu or not, dem go know sey one profet don kom meet dem. But yu, my pikin, even doh dem beat and do yu anyhow like sey yu dey stay with skorpions, make yu nor fear dem or anytin wey dem tok. Nor fear anytin wey dem tok or di way wey dem go dey look yu, bikos all of dem sturbon well-well. Yu go tell dem evritin wey I sey make yu tok, weda dem listin or not, bikos I know sey dem sturbon well-well. Man pikin, make yu listin to wetin I go tell yu. Make yu nor sturbon like dem. Naw, open yor mout make yu chop wetin I go give yu.”
So I si one hand dey kom meet mi and e hold one book wey dem fold. 10 Di hand open di book and dem rite put for di two side. Na kry, mourning and pains dem rite put for di book.