20
Israel Pipol Sin
Seven years afta dem karry Israel pipol go Babilon as prisonas, for di tent dey for di fift mont, some leaders for Israel kom my house kon sidan for my front dey ask mi sey wetin God wont. Den God kon tell mi: “Man pikin, tell dis men wetin God wey get pawa dey tok: Una don kom ask wetin I wont, abi? As long as I bi di God wey dey alive, I nor go let una ask mi anytin.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
“Man pikin, yu don ready to judge dem? Yu don ready to judge all of dem naw? Den, make yu judge dem. Remind dem about all di bad-bad tins wey dia papa don do before. Tell dem wetin I dey tok. Wen I choose Israel, I promise Jakob shidren-shidren kon show mysef and tell dem wen dem dey Egypt sey: ‘Na mi bi di Oga wey bi dia God.’ Dat time, I promise sey I go take dem komot from Egypt go di land wey I don choose for dem. Di land wey dey okay, good and e fine well-well. I tell dem sey make dem trowey all dia juju and make dem nor dirty demsef with Egypt juju, bikos na mi bi di Oga wey bi dia God. But dem rijet mi and nor gri listin to mi. Dem nor gri trowey dia juju or stop to woship Egypt gods and naw, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish. But I nor do am, bikos I nor won disgrace my name. I nor go spoil my name give doz nashons wey si mi wen I dey take my pipol komot Egypt 10 and true-true, I take dem komot Egypt go inside di wildaness.
11 “I give dem my kommand kon tell dem my laws wey dey give life to doz wey obey am. 12 I still give dem my Sabat wey go show my promise with dem, so dat dem go remember sey na mi make dem dey holy.
13 “But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish. 14 But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt. 15 So, I kon swear for dem di wildaness sey, I nor go take dem go di land wey I don promise dem; land wey dey okay, good and fine well-well. 16 I tok like dat, bikos dem don break my law, rijet my kommand kon distroy di Sabat. Dem like to woship juju well-well. 17 But I still sorry for dem kon gri sey I nor go kill dem for di wildaness. 18 Instead, I warn di yong pipol wey dey with dem sey: ‘Make una nor follow di laws wey una papa dem make or follow wetin dem dey do or serve di juju wey dem dey serve. 19 Na mi bi una Oga and God, so make una obey my laws and kommand. 20 Make una keep di Sabat holy, so dat e go bi sign for di kovenant wey wi make and e go remind una sey na mi bi di Oga wey bi una God.’
21 “But dat generashon still rijet mi. Dem break my laws and dem nor gri keep my kommand wey dey give life to doz wey obey am. Dem distroy di Sabat finish. So, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish and I like to kill all of dem as dem dey di wildaness, 22 but I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt. 23 So I kon swear again for di wildaness. I swear sey I go skata dem for evriwhere for di world. 24 I do like dis, bikos dem don rijet my kommand, break my law kon distroy di Sabat Day and dey serve di same juju wey dia grand-grand papa dem serve. 25 Den I give dem wiked laws and kommand wey nor dey give life. 26 I allow dem distroy dia life with dia own ofrin kon let dem sakrifice and kill dia first pikin. Dis na to ponish and show dem sey na mi bi God.
27 “Naw, man pikin, make yu go tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tell dem, Na so una papa dem take curse mi wen dem nor gri do di rite tin. 28 I bring dem kom di land wey I don promise sey I go give dem. Wen dem si how di tree for der fine and how di mountin tall rish, dem kon bigin sakrifice give di tree and mountins. Dem make mi vex, bikos of di sakrifice wey dem dey burn and di wine wey dem dey offa as ofrin. 29 I kon ask dem: ‘Wetin bi dis high place wey una dey go?’ (Dis na pagan shrine and na Bama wey mean high place dem dey koll am kon rish today.)
30 “Naw, make yu tell Israel pipol wetin I dey tok: Why una dey kommit di same sin wey una papa kommit kon dey run follow dia juju. 31 Even till today, dem still dey offa di same sakrifice and dey distroy demsef with di juju, bikos dem dey burn dia shidren for fire gi-am as sakrifice. Den Leta, una go still kom ask sey wetin I wont! But as long as I bi God wey get pawa and di God wey nor dey die, I nor go let una ask mi anytin.
32 “Una gri sey una won bi like di oda kountries; like pipol for oda kountry wey dey woship three and mountin. But una plan nor go work. 33 True-true, mi wey bi God wey get pawa, na mi bi di God wey nor dey die and I dey warn una sey if I vex, I go rule una with strong hand and with all my pawa. 34 Bikos I dey vex, I go use my strong hand take gada una togeda kom back from di kountries where I bin skata una go. 35 I go take una enter di wildaness wey dey di nashons and wi go stand face-to-face as I dey judge una. 36 As I take kondemn una grand-grand papa for Sinai wildaness, na so too, I go take kondemn una. Na God wey get pawa tok like dis. 37 Na mi, God dey kontrol una, so dat una go obey my kommand. 38 Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”
39 God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju. 40 All of una for Israel go woship mi for di land wey dey on-top my holy mountin. I go dey good to una, so I espect una to give mi una sakrifice, betta ofrin and gifts wey dey holy. 41 Afta I don bring una kom back from di kountries where I skata una go before, I go asept di sakrifice wey una go give and evribody go si sey I dey holy. 42 Wen I don bring una kom back to Israel; di land wey I promise una grand-grand papa, den una go know sey na mi bi God. 43 Den una go remember all di yeye tins wey una do and di bad ones wey una do with una body. Una go vex for unasef, bikos of all di bad tins wey una bin do. 44 Dat time, bikos of who I bi, I nor go ponish una as e suppose bi, den una wey bi Israel pipol go know sey na mi bi God.”
God wey get pawa don tok.
Fire
45 God tell mi: 46 “Man pikin, look di sout-side for di kountry. Tok against di sout-side and en forest. 47 Tell di forest for sout sey make e hear wetin God dey tok: Look! I won start fire wey go burn all di tree wey dey inside yu; weda dem fresh or dry. Nor-tin go fit kwensh di fire. Di fire go from sout go nort and evribody go feel as di fire hot rish. 48 All of dem go si sey na mi wey bi God start di fire and nobody go fit off am.”
49 But I tell God, “Oga God wey get pawa, nor let mi do like dis, bikos di pipol don already dey komplain sey dem nor undastand wetin I dey tok.”