22
Jerusalem Sins
God kon tell mi: “Man pikin, yu don ready to judge di town wey dead body full? Tell dem all di bad-bad tins wey dem do. Tell di town wetin mi God wey get pawa dey tok: Bikos una don kill many of una own pipol kon make unasef dirty as una dey serve juju; I go soon get una time. Una really kill pipol and na di juju wey una dey serve, dey dirty una. So una day dey kom and una time go soon end! Na dis make mi allow nashons and kountries dey laf and fool una. Di kountries wey dey far and di ones wey dey near, go laf una, bikos una nor konfuse well-well.
“All di leaders for Israel trust dia pawa and dem dey kill pipol. Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again. Una nor dey respet di holy place or keep di Sabat holy. Some of una dey lie for pipol head, so dat dem go kill dem. Some dey chop food wey dem don sakrifice give juju and some like ashawo life. 10 Some dey sleep with dia papa wife, while odas dey force and sleep with woman wey dey si en period. 11 Some dey sleep with pipol wife or husband and odas dey sleep with dia pikin wife or dia half sistas. 12 Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.”
Dis na wetin God wey get pawa tok.
13 “Si, I dey klap my hand as una dey tif and kill. 14 Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok. 15 I go skata una go difren kountries and I go stop all dis bad tins wey una dey do. 16 So di oda nashons nor go respet una and una go know sey na mi bi God.”
God Fire Burn
17 God tell mi: 18 “Man pikin, Israel pipol nor dey yuzful to mi. Dem bi like iron, milk cup and sometin wey dem use remain. 19 Mi God wey get pawa dey sey, dem dey yuzles like di yeye tin wey dey kom out from iron afta dem don melt am. So, I go gada all of dem kom Jerusalem. 20 Just as dem dey put silva, koppa, iron, lead and milk cup for fire wey go melt dem, na so too I go vex gada una put for hot fire. 21 Yes! I go gada dem for Jerusalem kon put fire under where dem dey, den melt dem with my vexnashon. 22 Just as silva dey melt for fire, na so too dem go melt for Jerusalem, den dem go know and feel my vexnashon.”
Israel Leaders Sin
23 God tell mi again sey: 24 “Man pikin, tell Israel pipol sey dia land dey dry and rain nor go fall, bikos I dey vex. 25 Dia leaders bi like lion wey dey happy for di animal wey e kill. Dem kill pipol, take all dia money kon kollect di propaty wey dem fit kollect and naw, many wimen nor get husband again, bikos of dis tin wey dem do so. 26 Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again. 27 Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money. 28 Dia profets hide dis tins like wall wey dem kover with paint. Dem dey si wrong vishon and wetin dem sey go happen, na lie. Dem dey sey na God word dem dey tok, but mi God, nor tok to dem. 29 Doz wey get money dey shit and tif from oda pipol. Dem dey ponish poor pipol and dey kollect strenjas propaty.
30 “I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody. 31 So, I go pour my vexnashon for dia head kon distroy dem with fire, bikos of di bad tins wey dem do.”
God wey get pawa don tok.