27
Sorrowful Song For Tyre
God sey, “Man pikin, make yu sing sorrowful song for Tyre pipol; di town wey dey near sea where dem for dey do business with pipol from difren place. Go tell dem wetin God wey get pawa dey tok:
“Tyre pipol, una dey make mout
sey una fine.
Wota surround una house
and di pipol wey build una,
build una like fine ship.
Dem use wood from Mount Hermon
take build di ship
kon use cedar from Lebanon
take do en pole.
Dem use oak tree from Bashan
take do di padol
kon make di chair with wood from Cyprus,
den kover am with ivory.
Na linen dem take make di sail;
betta linen wey dem bring from Egypt
and na from far yu go know,
wons yu si am.
Purpol klot wey fine pass for Cyprus,
na-im dem take kover di window.
Di men wey dey padol una kanoe,
na from Sidon
and Arvad dem from kom.
Na una men wey sabi work
dey drive una ship.
Di karpenters na men
wey dem train well-well for Gebal.
All di drivers from di ship where dey pass,
dey do business with una.
10 Na men from Persia, Lydia and Libya
bi una sojas.
Dem dey keep dia shield and kap
for una barrak.
Na dem dey win war for una pipol.
11 Sojas from Arvad join
dey guide una wall
and na men from Gamad
dey guide una towa.
Dem dey sun dia shield for una wall
and na dem make una fine so.
12 “Una do business for Spain kon use silva, gold, iron, tin and lead take pay for evritin wey una buy. 13 Una do business for Greece, Tubal and Meshak kon sell una goods to get slaves and to kollect tins wey dem make with bronze. 14 Togarmah dey use dia horse and animals take buy tins from una hand. 15 Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get. 16 Aram pipol dey buy una goods. Dem give una emeralds, purpol klot, fine tins and linen, koral and rubis, so dat una go give dem some of una goods. 17 Judah and Israel pipol dey buy goods from una with wheat, honey, olive oil and spices. 18 Damaskus pipol dey buy una goods kon pay with wine from Helbon 19 and wool from Zahar. Vedan and Javan pipol dey give una iron and spices, so dat una go give dem some from wetin una get. 20 Dedan pipol dey give una klot wey dem dey put on-top horse, so dat una go give dem una goods. 21 Arab pipol and di rulers for Kedar dey give una lamb, sheep and goat just to get una goods. 22 Bikos of di tins wey una get, Sheba and Rama pipol dey give una jewels, gold and di spice wey fine pass. 23 Haran, Kanneh and Eden town; di sojas for Sheba, Asshur and Kilmad town; all of dem dey buy and sell with una. 24 Dem dey give una fine klot, purpol klot, fine gown, karpet wey dey shine and strong ropes. 25 Na big ship dem take dey karry una goods.
“Una bi like ship for sea
wey dem pak heavy load put.
26 But wen di men wey dey padol una ship,
padol am rish di river centre,
one wind from east go kom sink di ship.
27 Una with una many goods, drivers,
ship karpenter and sojas,
go die inside di sea
wen di ship don sink.
28 Di pipol vois go loud well-well
wen dem dey shaut,
bikos na die dem dey.
29 Evribody wey dey drive di ship,
go swim leave am.
Di drivers and evribody go swim
go stand for groun.
30 All of dem go kry well-well for una,
dem go pak dust for head
kon roll for ashes.
31 Dem go skrape dia hair for una
kon wear sak klot.
Dia heart go bitter as dem dey kry.
32 Dem go sing dis sorrowful song for una:
‘Any town dey wey bi like Tyre?
Naw e don die for sea!
33 Wen en men enter sea go,
dem dey give evry kountry wetin dem wont.
Kings get money,
bikos of di tins wey Tyre sell give dem.
34 Naw una don sink for sea.
Una dey di sea bottom.
Una goods and all una workers
don vanish with una.’
35 Evribody wey dey stay near di sea,
shok wen dem hear wetin happen to una.
Even dia kings dey fear
and e dey show for dia face.
36 Pipol wey dey sell and buy tins from oda nashons,
dey hiss for una; una own don finish
and una nor dey again.”