29
Profesy Against Egypt
Ten years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di twelft day for di tent mont, God kon tell mi: “Man pikin, make yu go tok against Egypt king. Tell am how I go take ponish both en and en pipol. Tell am sey dis na wetin God wey get pawa dey tok:
“Yu wey bi juju for wota,
I bi yor enemy naw.
Yu sey na yu get and kreate Nile River abi?
I go hook yor jaw
and fish for river go whole yu tit.
Den, I go drag yu komot from Nile River
with all di fish wey dey yor mout.
I go trow yu and all di fish
inside desert.
Yu go die for der
and nobody go beri yu.
Den I go give yor body to bird
and animals make dem chop.
Dat time, all di pipol for Egypt go know
sey na mi bi God.
Aldo Israel pipol bilive
sey Egypt pipol go kom help and fight for dem,
but di trut bi sey,
Egypt pipol na soft plant
wey dey grow for wota.
Dem whole yu with dia hand,
but yu break kon skata dia hand;
wen dem won rest on-top yu,
yu break dia back
and dem nor fit stand again.
“Naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go allow pipol kom attack una with swod and dem go kill una with una animals. Egypt go turn to where nobody dey stay. Den una go know sey na mi bi God. Bikos yu sey na yu get Nile River, 10 I don turn both yu and di river enemy. I go make evriwhere for Egypt empty and nobody go dey der again. From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout till e rish Sudan borda, 11 human being or animal nor go waka pass der again and for forty years, nor-tin go stay for der. 12 I go make sure sey na Egypt land empty pass for di world. For forty years, Egypt towns go skata. Yes! E go skata pass any oda place. I go make Egypt pipol bi strenjas and dem go dey look for where dem go stay. Dem go run go difren kountries kon stay with strenjas.”
13 God kon sey, “Afta forty years, I go bring Egypt pipol kom back from di kountries where I skata dem go 14 kon let dem stay for Egypt sout wey bi dia original house. For der, dem go bi pipol wey nor get pawa; 15 kountry wey weak pass and dem nor go ever fit rule any kountry again. I go make sure sey dem nor dey important and dem nor go fit make any kountry do wetin dem wont. 16 Israel pipol nor go ever go meet dem for help again. Bikos of wetin go happen to Egypt, Israel pipol go kon know sey, e nor even dey rite to go Egypt for help. Den Israel pipol go know sey na mi bi God wey get pawa.”
King Nebukadnezzar Win Egypt
17 Twenty-seven years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di first mont, God kon tell mi: 18 “Man pikin, Nebukadnezzar wey bi Babilon king dey go attack Tyre. E sey make en sojas karry heavy load and na dis make di hair for dia head fall komot and dia shoulder peel. But even with all dis hard work, di king and en sojas nor get any reward. 19 So, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: I dey give Egypt land to King Nebukadnezzar. E go skata Egypt kon karry all di money wey Egypt take dey pay en sojas, go. 20 I dey give Egypt as payment for di work wey e do, bikos en sojas dey work for mi.”
Mi, God wey get pawa, don tok.
21 “Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”