36
God Bless Israel
God sey, “Man pikin, make yu tell Israel mountin sey make dem listin to di message wey mi God wey get pawa dey tell dem. Israel enemies tok against dem sey, ‘Naw, dis old hill don turn awa own naw!’ So go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok. Wen di kountries wey dey near Israel katch and seize Israel mountin, evribody bigin laf dem. So di mountins, hills, rivers and valleys, make una listin to wetin mi God wey get pawa dey tell una. Aldo sey una towns skata naw and oda nashons dey curse and laf una, I dey vex naw, so mi wey bi God go ponish dem especially Edom pipol, bikos na dem laf una pass kon kollect una land.
“So, make yu profesai about Israel land kon tell di mountins, hills, rivers and valleys sey, ‘God wey get pawa sey: Di way di oda kountries trit una, dey make mi vex.’ So God dey promise sey, doz kountries wey bin laf una, I go must sofa dem too.
“But trees go grow again on-top Israel mountins and dem go bear fruits for my pipol Israel and una go-go back to una own land. I dey una side; I go make sure sey una land dey good and una go fit plant put again. 10 I go make una many. Una go stay for di town and evritin wey don skata before, una go ribuild dem back. 11 I go make una pipol and animals dey plenty evriday. Una go many pass as una bi before and una shidren go plenty. I go let una stay here as una dey before kon make una betta pass before. Den una go know sey na mi bi God. 12 I go bring my pipol, Israel kom back to dis land. Di land go bi dia own and dia shidren nor go ever hongry again.
13 “Mi, God wey get pawa sey, ‘Di land nor dey produce betta food so pipol and dia shidren dey die anyhow.’ 14 But from naw go, all doz tin nor go ever happen again.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
15 “Di land know go listin to doz kountries wey dey laf or curse en pipol. Di land nor go make una shidren hongry or die again.
Mi, wey bi di Oga God, don tok.”
Israel New Life
16 God kon tell mi: 17 “Man pikin, wen Israel pipol bin dey dis land, dem spoil am with di way dem dey do and bihave. I si sey dia karata nor dey good and klean and bi like woman wey dey si en period. 18 Bikos of di pipol wey dem don kill for di land and juju wey dem pak full am, I kon let dem feel as my vexnashon strong rish. 19 I kondemn and skata dem go evriwhere, bikos of how dem dey live dia life. 20 Dem dey disgrace my holy name for anywhere wey dem go, bikos pipol dey sey, ‘Dis pipol don komot from di land wey dia own God, give dem.’ 21 Na dis make mi dey koncern about my holy name wey Israel pipol dey make oda pipol spoil.
22 “Naw, make yu go tell Israel pipol dis message wey mi God wey get pawa get for dem: Wetin I won do nor bi bikos of una, but na bikos of my holy name; di name wey una don disgrace for evriwhere. 23 Wen I show di kountries how my name dey holy and great rish; di name wey una dey disgrace, dem go know sey na mi bi God.
Mi, God wey get pawa, don tok.”
“I go use una take show di kountries sey I dey holy. 24 From evry tribe, kountries or towns wey una dey, I go bring una kom back to una house. 25 I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty. 26 I go give una new heart; di one wey go make una obey my kommand. 27 I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una. 28 Den una go stay for di land wey I give una grand-grand papa dem. Una go bi my pipol and I go bi una God. 29 I go save una from evritin wey make una dey spoil before. I go kommand food make e plenty, so dat una nor go hongry again. 30 I go make di fruit and food for una tree and fields many pass before, so dat honga nor go make una go beg oda nashons. 31 Wen una remember di wiked and wrong tins wey una do before, una go hate unasef, bikos of una sins. 32 Israel pipol, I wont make una know sey I nor dey do all dis tins bikos of una. So make una shame and hide una face bikos of all di bad tins wey una don do.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
33 God wey get pawa sey, “Wen I don klean una from all una sins, I go let una plenty kon ribuild una towns wey don skata. 34 Doz wey pass una field before, si as dirty and grass grow full am, but naw, I go let una plant seed for der again. 35 Dis land wey bi like wildaness before, evribody go si and tok how e don turn and fine like Eden Gardin and how di town wey skata rish groun before, don fine and get pipol again. 36 Den di nashons wey dey near der, wey survive, go know sey mi wey bi God don ribuild dis town wey skata before kon plant put for di field wey bin dey empty. Mi wey bi God don promise sey, I go do wetin I sey I go do.”
37 God wey get pawa sey, “I go allow Israel pipol ask mi for help and dem go plenty like sheep again. 38 Just as sheep wey dem won offa as sakrifice dey full Jerusalem before di feast, na so too pipol go full di town wey bin dey empty. Den evribody go know sey na mi bi God.”