9
God Ponish Jerusalem
Den I hear God shaut, “Una wey won go ponish di town, make una bring una gun, swod and knife kom.” At wons, six men just kom out from di nort gate for di temple, each of dem karry swod. E get one man among dem wey wear linen and e whole sometin for hand wey e won take rite. All of dem kon stand near di bronze altar.
Den Israel God glory raiz-up from di creatures wey get feada kon move go di temple gate. God koll di man wey wear linen kon tell am, “Make yu pass thru evriwhere for Jerusalem kon mark di pipol front head; pipol wey dey face trobol and wahala, bikos of all di bad tins wey dey happen for di town.”
I hear wen God tell di oda men sey, “Make una follow am pass thru di town kon bigin kill pipol and make una nor sorry or leave anybody. Make una kill both old and yong pipol; weda na papa, mama or pikin. But make una nor tosh anybody wey get di mark for en head. Make una start from my temple.” So dem kon start with di leaders wey dey der.
God sey, “Skata di temple! Make dead body full inside! Make una start to kill!” So dem start to kill di pipol wey dey for di town. Na only mi dey der wen dem start to kill. So I fall face groun kon shaut, “Oga God wey get pawa well-well, na so Yu dey vex for Jerusalem? Yu wont kill evribody wey dey Israel?”
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do. 10 But I nor go sorry for dem. Na wetin dem do oda pipol, na di same tin I go do dem.”
11 Den di man wey wear linen klot, kom back kon tell God sey, “I don do as Yu sey make I do.”