10
Mordekai
Di pipol wey dey near di sea for di kingdom, King Zazes kon force dem dey work well-well. Naw, all di great and wonderful tins wey e do, with how e take promote Mordekai, dem rite dem for Media and Persia kings book. So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.