12
God Free Israel Pipol
God tell Moses and Aaron for Egypt, “Dis mont na di first mont for di year for una. Make una tell Israel pipol sey, ‘For di tent day for dis mont, all di men go choose one yong sheep or goat for en family. If en family too small to chop one full animal, en and en neighbour wey dey stay near am go share one animal akordin to di pipol and how dem go fit chop rish. Make di animal wey una choose dey okay; animal wey neva pass one year and e must bi man sheep or goat wey nor dey cripple or get sickness.
“ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals. Dem go take some of di blood put for di two door post and on-top di door for all di house wey dem go for chop di animal. For dat same nite, dem go roast and chop di meat with bitter leaf and bread wey nor get yist. Make una nor chop raw or meat wey dem boil, but make una roast am for fire well-well with en head, leg and all di parts for en body. 10 Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
11 “ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova. 12 Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God. 13 Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol. 14 Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.
Bread Wey Nor Get Yist Feast
15 “ ‘For seven days, una must chop bread wey nor get yist. So for di first day, una must remove di yist wey dey una house, bikos if anybody chop bread wey get yist from di first day go rish di sevent day, I go kill-am. 16 For di first and sevent day, make una gada kom woship mi. Nobody go work for doz days, escept una won do wetin una go chop.
17 “ ‘So make una kontinue to celebrate dis feast, bikos na di day wey I take una komot from Egypt and una go dey celebrate am forever. 18 For evening for di fourteent day for di first mont, make una chop bread wey nor get yist, until di twenty-first day evening for di same mont. 19 Yist must nor dey una house for seven days and anybody wey chop anytin wey get yist, nor go dey among Israel kommunity again. Weda na strenja or Israel pesin wey dem born for di land. 20 Make una nor chop anytin wey get yist and anywhere wey una go stay, una must nor chop bread wey get yist.’ ”
First Passova
21 Den Moses gada di eldas for Israel kon tell dem, “Make all di family kill one yong sheep or goat take celebrate di Passova. 22 Make una deep di plant wey dem dey koll hyssop inside di blood, den take di blood rub di two pole for di door and di one wey cross dem for up. And make anybody nor komot from inside en house until morning. 23 Bikos Oga God go waka pass Egypt kon kill pipol, but wen E si di blood for di up and two side for una door, E go waka pass and E nor go enter una house kon kill una.
24 “Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever. 25 And wen una don enter di land wey di Oga una God go give una, just as E tok, una must do dis ofrin. 26 Wen una shidren ask una sey, ‘Wetin dis ofrin mean?’ 27 Den una go ansa, ‘Na di Passova sakrifice for di Oga awa God, wen E kill Egypt pipol kon save wi and awa family.’ ” Den Israel pipol bow woship 28 kon do as God kommand dem thru Moses and Aaron.
God Save Israel Pipol
29 Dat nite, Oga God kill all di first-born son for Egypt and na from Fero first-born go rish doz wey dey prison and di animals first-born. 30 Fero with all en savants and evribody for Egypt wake-up for nite bigin kry well-well, bikos e nor get any house where pesin nor for die.
31 Dat same nite, di king kon sey make dem go koll Moses and Aaron, den e tell dem, “Make yu and yor pipol komot from my kountry go woship di Oga una God, just as yu tok. 32 Make yu still take una sheep, goat and kattles follow body. But bless mi too.” 33 Egypt pipol bigin enkourage Israel pipol, so dat dem go kwik komot, bikos dem dey sey, “All of us go die finish, if una nor komot for here.”
34 So di pipol fill dia bakin pan with bread wey nor get yist, tie am join dia klot kon karry dem put for dia shoulder. 35 Israel pipol kon do as Moses tell dem. Dem ask Egypt pipol for silva, gold and klot. 36 God make Egypt pipol favor en pipol and dem kon give Israel pipol evritin wey dem wont. Like dis, Israel pipol karry all di propaty for Egypt follow body.
Israel Pipol Komot From Egypt
37 Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am). 38 Many strenjas still follow Israel pipol komot from Egypt with all dia sheep, goat and kattle. 39 Dem bake bread wey nor get yist with di bakin pan wey dem dey karry komot Egypt. Di bread nor get yist, bikos dem hurry dem komot from Egypt, so dem nor get time to prepare food for demsef.
40 Israel pipol stay for Egypt for four hundred and thirty years. 41 Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete. 42 Na dat nite God take save dem komot from Egypt and dem go dey dedikate dat nite to God from one generashon go rish anoda.
Di Passova
43 So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food. 44 But any slave wey yu buy wey dem sekonsaiz, fit chop am. 45 Any strenja or worker wey dem hire must nor chop from am. 46 Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone. 47 Israel pipol must always dey celebrate dis feast.
48 “Any strenja wey dey stay with una wey like to celebrate Oga God Passova, dem must sekonsaiz dia men, den una must si dem as Israel pipol. 49 Anybody, weda dem born as Israel pesin or strenja wey dey stay with una, must obey dis law.”
50 So Israel pipol kon do as Moses and Aaron kommand dem. 51 For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.