26
Tabanako
“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work. Each of di curtain go long rish forty-two fit and wide rish six fit. Make yu join five curtain togeda. Yu go take blue klot make ring for di curtain korna wey dey di end part for one set and like dis too, yu go make rings for outside di oda curtain korna for di sekond set. Yu go make fifty ring for one curtain kon make anoda fifty ring for di curtain end wey dey di sekond set, so dat di rings go hold one anoda. Den yu go make fifty gold hook take join di two set as one.
“Make yu make kover for di Tabanako with eleven curtain. Di curtain go long rish forty-five fit kon wide rish six fit. Den yu go join five curtain togeda kon join di remainin six togeda. Fold di nomba six curtain two times for di Tabanako front. 10 Yu go make fifty ring for di korna for di last curtain for one set and fifty ring for di korna for di curtain wey join di sekond set. 11 Yu go make fifty bronze hook kon put di bronze hooks inside di rings, den join di tent togeda, so dat evritin go form one kover. 12 Yu go hang di half tent curtain wey remain for di tent back. 13 Di one and half fit for di curtain lengt wey remain for di two side, yu go use am kover di two side. 14 Make yu take ram skin wey dem dye with red take make kover for di tent, den kover dis ram skin with fine leda.
15 “Yu go still take akasia wood do two stand as frame for di tent. 16 All di frame go long rish fifteen fit kon wide rish two fit three inches, 17 with two tins wey kom out, so dat dem go fit join di frames togeda. All di frames go bi di same. 18 So, make yu make di frame for di Tabanako and yu go make twenty for di sout-side 19 kon make forty silva wey go dey under di twenty frame; two silva go dey under one frame, bikos of di two tins wey dem go do kom out from am. 20 For di nort side for di tent, make yu make twenty frame 21 with dia forty silva bottom and two go dey under di next frame. 22 For di tent back wey face di west side, yu go make six frame. 23 Yu go make two frame for di tent korna for di two back-side. 24 For di two korna side, yu must doubol am for bottom, den kon finish di top as one ring and e go bi for di two korna. 25 So na eight frame go dey with dia sixteen silva bottom and two for di bottom go dey under di next frame.
26 “Den yu go take akasia wood take make some bar: five na for di frames for one side for di Tabanako 27 and five bar na for di frames for di oda side. Yu go still make five bar for di frames wey dey di back-side wey face west. 28 Di bar wey dey middle for where di oda frames dey, go long from one end go rish di oda. 29 Make yu kover all di frames with gold kon make dia rings with gold, den make one place for di bars. Yu go still kover all di bars with gold.
30 “Yu go build di tent as I show yu for di mountin.
31 “Make one curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon draw di angel wey get feada inside. 32 Den yu go hang am with gold hook for di four post wey dem make with akasia wood kon kover dem with gold. 33 Hang di curtain under di hook for di tent roof and for di curtain back. Yu go put di Kovenant Box for der. Di curtain go separate di Holy Place from di Holy of Holy.
34 “Put di kover on-top di Kovenant Box wey dey inside di Holy Place. 35 Make yu put di tabol for outside di Holy Place and di lampstand go dey opposite di tabol near di tent kon face sout, den yu go put di tabol for di nort side.
36 “For where dem go pass enter di tent, yu go make fine linen curtain wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with design. 37 And yu go still make hooks for dis curtain and five post with akacia wood kon kover dem with gold. Den do five bronze bottom for dem.