5
Freedom Wey Bilivers Get
Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free. Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again. And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok. Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace. Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye. For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut? Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis! Na small yist dey make bread raiz! 10 I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi. 11 Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol. 12 I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!
Paul Prish About Love
13 My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda. 14 Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.” 15 But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake. 16 I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont. 17 Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont. 18 But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again. 19 Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol; 20 to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol; 21 bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
22 But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes, 23 gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins. 24 Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do. 25 If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont. 26 Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.