11
Faith
Faith na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go happen and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom. Na faith awa grand-grand papa dem take do tins wey make God praiz dem. Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si. Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith. Na faith nor let Enoch die, but God karry am take and nobody si am. God word sey, before God karry am, Enoch don make belle sweet God. Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si. Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.
Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go. Na faith make am stay as strenja for di land wey God promise am. Na inside tent en, Isaak and Jakob wey go inherit di same promise, stay. 10 Abraham do like dis, bikos e dey wait for di town wey God ensef go build with strong foundashon. 11 Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust. 12 So from dis one man wey en body don die finish, shidren wey plenty rish stars for sky and san for wotaside kon full evriwhere. 13 All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world. 14 Pipol wey tok like dis, show evribody sey dem dey espect dia own kountry. 15 Infact, if to sey dem dey tink of di kountry where dem from kom, dem for get mind to go back. 16 But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem. 17 Na faith make Abraham offa Isaak wen God dey test am. Even doh na God gi-am di pikin, e still ready to give di only pikin wey e get, back to God. 18 God tell am before sey, “True Isaak, yor family go many well-well.” 19 Dis na bikos Abraham bilive sey, even if Isaak die, God go raiz am from deat and true-true Abraham really kollect Isaak back from deat. 20 Na faith make Isaak bless Jakob and Esau about dia future. 21 Before Jakob die, na faith e take bless Josef shidren and woship God as e rest on-top en walkin stik. 22 Wen Josef life don dey end, na faith e take tok about di long travel wey Israel pipol go-go and e tell dem wetin dem go do with en bones.
23 Na faith make Moses papa and mama hide am wen dem born am, bikos dem si sey di pikin fine and dem nor fear to disobey wetin di king kommand. 24 Wen Moses kon grow up, na faith make am nor gri make dem koll am Fero dota pikin. 25 Instead of am to enjoy tins wey go make am sin, e kon choose to sofa with God shidren. 26 E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward. 27 Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si. 28 Na faith make Moses do di Passova and pour blood for pipol door-mot, so dat God angel wey dey kill all di first-born for Egypt, nor go tosh dem. 29 Na faith make Israel pipol cross di Red Sea like sey na dry land, but wen Egypt pipol try am, di wota swallow all of dem. 30 Na faith make Jeriko wall fall afta Israel pipol don mash round am for seven days. 31 Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
32 Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets, 33 na faith dem take win kingdoms; do wetin good for God eye; kon get di tins wey God promise dem; klose lion mout; 34 kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem. 35 Some wimen wey dia pipol don die, na faith make dem receive dem back, alive. Some pipol rijet freedom kon die for sofa, so dat dem go fit wake-up from deat and enter life wey betta pass dis one. 36 Pipol laf some; flog some; shain some and put odas for prison. 37 Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow. 38 (Dis world nor good rish for dem); dem just dey waka about for wildaness, on-top mountins, inside rock and holes. 39 God praiz all of dem for dia faith, yet dem nor still get wetin God promise. 40 Bikos God plan sey, without us, dem nor go fit get di tins wey E promise dem.