3
Jesus And Moses
My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive. E obey God wey choose am as High Priest, just as Moses obey God. Just as dem dey praiz pesin wey build fine house, pass di house wey e build, na so too Jesus glory betta pass Moses own well-well! Na pesin build evry house, but di pesin wey build evritin, na God. True-true, Moses really obey God as savant and e tok about some tins wey God go tok about leta. But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.
God Word True Faith
As di Holy Spirit tok:
“If una hear God vois today,
make una listin to am!
Make una nor get strong heart for am,
bikos na so Israel pipol do wen God test dem for wildaness.
Na for di wildaness una papa
for test and try mi for forty years,
even doh dem si di mirakles wey I do.
10 I vex well-well for dat generashon,
so I kon tell dem,
‘Una heart nor dey with mi
and una nor gri obey wetin I tok.
11 So, una nor go ever get rest.’ ”
12 Make una make sure sey non of una get bad mind wey go make una nor bilive, so dat una nor go turn against God wey nor dey die. 13 But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin. 14 Bikos wi go bi Jesus Christ friend, if wi whole awa faith strong go rish di end. 15 But as dem rite am, “I wish sey una go do wetin e tok, so dat una nor go get strong heart like Israel pipol wen dem dey wildaness.” 16 Na who bi di pipol wey nor listin to God, even doh dem hear en vois? Nor bi pipol wey Moses lead kom out from Egypt? 17 Na who make God vex well-well for forty years? Nor bi doz sinnas wey dia dead body skata for wildaness? 18 Na who God swear for sey, dem nor go ever get rest, nor bi doz wey disobey am? 19 So for dat time, doz pipol nor enter di land wey God promise dem, bikos dem nor bilive am.