8
Di Priest With New Kovenant
Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven. Na-im bi di priest wey dey di holy Temple wey God build and na der dem for dey woship am. Since all High Priest must offa gifts and sakrifice to God, Christ too must offa sometin. If to sey e dey dis world, e nor for bi priest at-all, since na thru Moses Law dem take dey choose priest wey go offa sakrifice. Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.” But Christ ministry big and betta pass dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) betta pass. Bikos na thru God promise dis kovenant take kom, so Christ don bi di middo-man between wi and God.
If to sey di first kovenant good well-well, den wi nor for nid anoda one. But God si fault for inside, so E kon sey, “Di day wey I go make new agriment with Israel and Judah house, dey kom. E nor go bi like di kovenant wey I make with dia grand-grand papa dem wen I take dem komot from Egypt, bikos dem break dat kovenant and I kon turn against dem.” 10 But naw, “Dis na my new kovenant (wey bi di new agriment): Di time dey kom wen I go put my laws for dia mout and rite am for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol. 11 Dem nor nid to tish one anoda about mi wey bi dia God, bikos all of dem, both small and big, go know mi. 12 I go forgive dem for all di wiked tins wey dem don do and I nor go remember dia sins again.”
13 Wen God tok about di new kovenant, E mean sey di first one nor matter again. And anytin wey don old and nor get use again, go soon disappear.