13
Final Judgement
Before-before, wen Efraim pipol dey tok,
di oda tribes for Israel dey fear and respet dem.
But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju
and dis tin kon distroy dem.
Dem still dey sin and woship juju wey dem make
kon design am with silva.
Dem dey sey, “Make una kom sakrifice
and kiss dis juju!”
So just as dew dey vanish for morning,
na so dis pipol go disappear too.
Dem go-go like leaf wey breeze blow
or smoke wey dey fade.
God sey,
“Na mi bi di Oga una God
wey take una komot from Egypt.
Una nor get anoda God apart from mi.
Na mi dey save una.
Wen una dey dry land wey nor get anytin,
na mi take kare of una.
But naw wen una enter betta land, una don dey okay;
dey karry body up kon forget mi.
So, I go attack una like lion.
I go hide for bush dey wait una like leopard.
I go attack una like bear wey en pikin lost
kon tear una to pieces.
As lion and wiked animals dey distroy tins,
na so too I go distroy una.
Israel pipol, mi wey bi una only helpa
go soon distroy una.
10 Una dey ask for king and leaders;
how dem won take save una naw?
11 Na mi vex give una kings
and I still vex take dem komot.
12 I don gada Efraim pipol sin kon keep am
dey wait di time wen I go ponish dem.
13 Israel get shance to live,
but dem too dey foolish to si am;
just like pikin wey dem just one born,
wey nor gri kom out from en mama belle.
14 I nor go save dis pipol from grave
or save dem from deat pawa.
So deat, make yu bring all yor wahala kom!
Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom,
bikos I nor go pity for dis pipol again.
15 Even doh Israel dey grow like betta grass,
I go send hot desert breeze from east
kom dry dia rivers and well.
E go distroy evritin wey dem value.
16 I go ponish Samaria pipol,
bikos dem nor gri listin to mi.
Dem go die for war; dia shidren go fall
kon skata
and dia wimen wey get belle,
dem go tear dia belle open with swod.”