8
God Kondemn Israel
“Blow di trumpet!
Enemies dey rush dey kom
attack my pipol like eagle!
My pipol don break di kovenant wey I make with dem
kon go against my laws.
Even doh dem sey I bi dia God
and dey klaim sey dem bi my pipol wey know mi.
But naw, Israel pipol dey beg mi sey,
‘Make Yu kom help us bikos Yu bi awa God!’
But e don late well-well,
bikos dem don rijet wetin dey good,
so dia enemies go porshu dem well-well.
Na only my pipol choose king and leaders
demsef without sey I permit dem.
Dem make juju with dia silva and gold;
juju wey dey kause wahala for dem.
I hate di gold melu wey Samaria pipol dey woship.
I dey vex well-well for dem.
Na wen dem go stop to woship juju?
Na una Israel pipol karve di juju by unasef.
Di juju nor bi god!
Di gold melu wey una dey woship for Samaria,
go skata to pieces!
Wen una plant breeze,
una go harvest heavy rain.
Una korn nor go produce bread.
Even if e produce,
na strenjas go chop am.
Israel pipol bi like oda nashons naw
and dem dey yuzles like pot wey break.
Israel pipol sturbon like wiked donkey
and dem don waka go dia own way.
Dem don go meet Assyria pipol make e help dem
kon pay oda nashons to protet dem.
10 But naw, I go gada dem togeda
kon ponish dem.
E nor go tey before dem go kry with pain
wen Assyria king go kom opress dem.
11 Di more Israel pipol dey build altar to remove sin,
di more dem dey get many place
where dem go for dey sin well-well!
12 I rite many-many laws for di pipol,
but dem dey rijet dem,
bikos dem won follow strenj and yeye god.
13 Dem dey offa sakrifice give mi
kon chop di sakrifice meat.
But mi wey bi God nor dey happy with dem
and naw, I go remember dia sin kon ponish dem.
I go send dem go back to Egypt!
14 Israel pipol build royal palis,
but dem don forget who kreate dem.
Judah pipol don build many strong town,
but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”