46
Babilon Juju
“Bel and Nebo town don fall.
Dem pak dia juju on-top donkey and naw,
di juju too heavy for di donkey to karry.
Di juju wey stand before don fall;
dem nor fit save diasef
and dem don karry di juju dem go as slave!
So Jakob shidren-shidren, make una listin;
una wey remain for Israel,
pipol wey I dey kare for,
since dem born una.
Even wen una don old kon get white hair,
I go still dey kare for una.
Na mi kreate una,
so I go support, help and save una.”
God sey,
“Na who una fit take kompare mi?
Make una tell mi,
abi e get anybody wey fit bi like mi?
Pipol dey pour gold from dia bag
kon measure dia silva.
Dem go hire pesin wey go use di gold
make juju for dem and den,
kon woship am.
Dem go karry am for dia shoulder dey waka
kon go put am for where e go dey.
E nor go fit komot
for where dem put am.
Even wen pesin pray to am,
e nor go fit ansa
or save di pesin from wahala.
Una wey dey tok against God,
make una remember
and tink of all wetin God don do.
Make una remember wetin happen before-before!
Na mi bi God and e nor get any oda god.
Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi.
10 I know di end from di biginnin
and na from wen I kreate di world I don dey tok tins
before dem happen.
I sey na as I plan am,
na so e go bi and I go do am as I wont am.
11 I koll one eagle kom from east;
from one far land,
di one wey dey kom do wetin I plan.
Just as I tok, na so e go bi
and wetin I plan, must happen.
12 So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin,
make una listin to mi.
13 I dey kom judge
and diliver my pipol.
E nor go tey again
and di time to save dem don near.
I go save Jerusalem
kon honor Israel pipol.”