48
Na God Bi God
Jakob shidren-shidren, make una listin to mi.
Una wey bi Israel pipol wey kom from Judah tribe:
pipol wey swear with God name sey,
“Na Israel God wi dey woship,”
but una nor mean wetin una dey tok.
Una wey sey una kom from di holy town
and dey put una hope for Israel God
wey bi di Mighty God.
God sey,
“I dey tok about di tins wey go happen before e happen.
Den na wons I do dem and dem kon happen.
Bikos I know how una sturbon rish;
una neck strong like iron
and una head bi like bronze.
So, I don tell una about dem since,
even before dem happen,
I don tell una, so dat una nor go sey na una juju
and image make dem happen.
Una don hear and si evritin
wey I tok sey go happen.
Una go fit deny sey I nor tell una before?
From naw go, I go tell una new tins wey go happen,
wey una neva hear or know about before.
I just kreate dem naw,
nor bi tins wey dey before
and una neva hear about dem until today.
So una nor go fit sey,
‘Yes! Wi know about dem before!’
Una nor dey hear or undastand;
na since dem born una,
una ear block.
Yes, I really know how una wiked and sturbon rish
and na wiked pikin dem dey koll una since dem born una.
But bikos of my name,
I nor gri ponish una;
bikos of my praiz,
I nor gri distroy una at-all.
10 Naw, make una si as I don klean una
and nor be like silva;
but na betta sofa and wahala
I take test and klean una.
11 Na bikos of mi, I dey do am.
Yes! I dey do all dis tins bikos of mi.
I nor go fit let una spoil my name.
I nor go let anybody share my glory with mi.
12 Jakob shidren-shidren,
make una listin to mi!
Israel pipol wey I don koll, na mi bi God:
na mi bi di first and na mi still bi di last.
13 Na my own hand I take make di eart foundashon
kon spread di heavens with my rite hand
and wen I koll dem,
all of dem dey stand kom togeda.
14 So, make all of una gada kon listin to mi!
Wish one among una juju don tell una all dis tins before?
Di sojas wey God choose
go do wetin E plan against Babilon.
15 Mi! Yes mi, wey bi God, don tok; yes I don koll am,
I go bring am kom
and e go do wetin I tell am
sey make e do, well.
16 So make una kom near mi
and listin to wetin I dey tok:
‘Since I start to tok, I nor hide dey do am;
so wen e go happen, I go dey here.’
And naw, Oga God wey get pawa
don send mi with en Spirit.
17 God wey save una,
di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok:
‘Na mi bi di Oga una God,
di Pesin wey dey tish una wetin dey good.
Di One wey dey show una di road
wey una go follow.
18 If to sey una just gri listin to my kommand,
una peace for bi like river
and una raitiousness for bi like wave for sea.
19 Una shidren-shidren for plenty like san-san,
like korn wey dem nor go fit kount;
nobody go fit remove dia name or distroy dem from my present.’
20 So naw, make una komot from Babilon,
make una run komot from der!
Make una shaut with joy as una dey tok about am.
Make una tell evribody for di world sey,
‘God don save Jakob en savant.’
21 Wota nor hongry dem wen E take dem pass di desert;
E tear rock open,
Yes! E make wota flow kom out from di rock.
22 Oga God sey,
‘Wiked pipol nor go ever get peace.’ ”