54
God Love Israel
“Wimen wey neva born pikin before,
naw, make una sing and shaut with happiness,
bikos di shidren wey una go born,
go plenty pass di ones wey di woman wey get husband, born.
Make una make una house big well-well;
make en rope and en peg dey strong well-well.
Una go spread go rite and left;
una shidren-shidren go kover evriwhere
kon stay for town wey dem don forget before.
Make una nor fear,
dem nor go disgrace una again.
Make una nor fear at-all,
bikos una nor go face shame again.
Una go forget una shame wey happen wen una dey small
and una nor go remember di sofa
wey una sofa wen una nor get shidren.
Bikos di Pesin wey kreate una,
go bi una husband.
Na God wey get pawa bi en name.
Israel God wey dey holy go save una.
Dem dey koll am di God of di whole eart.
Israel pipol, una bi like yong wife
wey sorrow full en heart,
bikos en husband leave am.”
But God dey koll una kom meet am sey,
“Even doh I leave una for shot time,
I go take una back and show una my love
wey nor dey end.
I vex leave una small,
but I go show una my love forever.”
Na so God, wey save una, tok.
“I promise una for Noah time
sey I nor go use wota distroy di world again.
Naw, I dey promise sey I nor go vex for una again
and I nor go rebuke or ponish una again.
10 Even doh di mountins and hills go skata,
di love wey I get for una, nor go ever end.
I go keep my peace and promise forever.”
Na God wey love una, tok all dis tins.
Jerusalem Wey Dey Kom
11 God sey, “My Jerusalem;
di town wey dey sofa and nor get help;
di place wey nor get who go konfort am.
I go use stones wey dear well-well
take build una foundashon again.
12 I go build una towa with rubi kon use stones
wey dey shine like fire take build una gates.
And di wall wey surround una,
na jewels I go take build am again.
13 Na only mi go tish una pipol
and I go give dem peace kon make dem prosper.
14 Na raitiousness go make una strong.
Una go dey save from pipol wey dey opress una
and from doz wey dey kause wahala.
15 Anybody wey attack una,
do am on en own and anybody wey dey fight una,
go fall.
16 Na mi kreate di man wey dey melt gold,
make fire and form weapon
and na mi still kreate di soja wey dey use di weapon kill pipol.
17 But nor-tin wey pipol use against una,
go fit distroy una;
una go ovakom evribody wey dey akuiz una.
Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy
and I go defend and make dem win.”
Na so God tok!