57
Israel Yeye Life
Raitious pipol dey die
and nobody undastand or even kare.
Betta men dey die,
yet nobody dey si di evil wey dey kom.
Pipol wey dey live betta life,
get peace and dem dey rest even wen dem don die.
But una wey bi sinnas!
Make una kom here make dem judge una!
Na pipol wey dey do majik and ashawo born una.
Who una dey fool?
Who una dey laf and lie give?
Una dey woship yeye gods
and dey sleep with each oda under doz trees.
Una dey sakrifice una shidren for di rock
wey dey near di stream.
Una take smooth stones from der
kon dey woship am as god.
Una pour wine put kon give dem rice as ofrin.
So, una tink sey I dey happy
with all dis tins wey una dey do?
Una dey go di mountins wey high pass go sakrifice
and sleep with one anoda.
Una put una juju for una door-mot
and una nor dey respet Mi wey bi God!
Una pul una klot, klimb bed with una love
wey una give money make dem for sleep with una.
Den una kon satisfy unasef.
Una dey put perfume and oil for body
go woship Molek wey una dey koll god.
Bikos una dey find gods to woship,
una dey send messenjas go far,
even go rish where dead body dey.
10 Naw, make una si as una dey work hard
to find oda gods and yet e nor dey taya una.
Una tink sey na bikos una juju dey give una pawa,
na-im make una nor dey taya to work?
11 God sey, “Who bi all dis gods
wey make una dey fear and lie for mi?
Wey make una forget mi like dis?
Una don stop to honor mi, bikos I don too kwayet?
12 Una tink sey wetin una dey do dey rite,
but I go disgrace una and una juju nor go fit help una.
13 Wen una kry for help,
make una juju kom save una.
Na one small breeze go karry dem go!
But pipol wey trust mi go stay di land
kon woship mi for my temple forever.”
God Promise To Help And Heal
14 God sey, “Klear di road! Klear di road!
Make una remove di tins wey fit stop my pipol
to turn back kom meet mi!
15 Na mi bi di high and holy God,
di Pesin wey go live forever.
Where I dey stay, dey high and holy,
but I still dey stay with pipol wey dey honbol
and ready to turn from sin kom meet mi,
so dat I go give dem mind and hope again.
16 I give my pipol life
and I nor go kontinue to curse or vex for dem forever.
17 I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot,
so I kon ponish and abandon dem
bikos dem sturbon and dey do as dem like.
18 I don si how dem dey bihave,
but I go heal dem.
I go lead and help dem and I go konfort doz
wey dey mourn.
19 I go give peace to evribody,
both doz wey dey far and near!
I go heal my pipol.
20 But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow;
en wave nor dey finish
and na so-so dirty e dey bring.
21 Wiked pipol nor go ever get peace of mind.”
Dis na wetin God tok.