63
God Win Di Nashons
“Who bi dis pesin wey dey
kom from Bozrah wey dey Edom?
Who wear fine red klot dey waka
kom with pawa and strent?”
Na mi God wey dey speak with raitiousness,
wey dey mighty and get pawa to save.
“Why en klot red like dat?
Why e red like man wey dey mash grapes to take make wine?”
God ansa, “I mash di nashons like grapes by mysef.
I use my vexnashon mash dem
and na dia blood stain my klot so.
I just feel sey di time to save my pipol don rish
and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.
I sopraiz wen I si sey nobody dey to help doz wey dem dey opress.
So, mi mysef kon go save and diliver dem with my strong hand.
I mash di nashons as I dey vex kon skata dem.
Den I pour dia blood for groun.”
God Dey Good To Israel
I go tok about God love wey nor dey fail.
I dey praiz am for wetin E don do for us.
E don bless Israel pipol well-well,
bikos of en mesi and love wey nor dey fade.
God sey, “Dem bi my pipol
and dem nor go lie give mi.” E save dem
from all dia sofa. Nor bi angel save dem,
but na God save dem by ensef.
E use en love and mesi take save dem.
E dey kare for dem since,
10 but dem fight against am
kon make am vex.
So God kon bi dia enemy
and E fight against dem too.
11 Den di pipol remember as e bi before;
dat time wen Moses take dem komot from Egypt, so dem ask,
“Where di God wey save en pipol from di sea?
Where di God wey give Moses en Spirit?
12 Where God wey do great tins thru Moses wey divide di sea
kon lead en pipol pass di deep wota,
so dat honor and glory wey nor dey end,
go bi en own?”
13 Dia leg strong for groun like horse wey dey run fast
and dem nor fall, bikos God dey lead dem.
14 Just as dem dey lead melu go valley wey get betta grass,
na so too God dey give en pipol rest.
E lead en pipol kon bring honor to en name.
Prayer For Help And Mesi
15 Oga God! Make Yu look us from heaven,
yor holy place where Yu dey stay wey get glory.
Where yor pawa and strong mind dey?
Where yor love and mesi dey?
Make Yu nor leave us at-all.
16 Na Yu bi awa papa.
Even if Jakob and Abraham wey bi awa grand-grand papa
sey dem nor know us,
Yu God na awa papa
and na Yu dey always save us.
17 Why Yu make us komot from yor plans and ways?
Why Yu make us sturbon like dat,
sotey wi turn from Yu?
Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu
and bikos of di pipol wey bi yor own.
18 Na small time wi spend for yor house
before awa enemies drive us kon skata yor temple.
19 Wi bi yor own from biginnin;
but Yu neva rule dem before
and nobody don ever koll dem with yor name.