65
God Ponish Sinnas
God sey, “I bin dey ready to help my pipol,
but dem nor kom meet mi make I help dem.
I bin dey ready make dem look for mi,
but dem nor even try.
All di nashons nor pray to mi,
even doh I dey ready to ansa sey:
‘Na mi bi dis, I go help una.’
I always dey ready to welkom my pipol wey dey sturbon,
dey do wrong and dey go dia own way.
Dem dey always make mi vex,
as dem dey offa juju sakrifice inside di holy gardin
kon burn incense for di stone altars.
Dem dey go grave for nite go beg dead body spirit
make e help dem.
Dem dey chop pig and drink wetin kom out from di meat
wey dem sakrifice give juju.”
Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us,
wi dey too holy for una to tosh!
Doz pipol bi like smoke for my nose,
bikos my vexnashon for dem bi like fire
wey nor dey kwensh.
I don already know how I go take ponish dem
and dem don rite di way dem go take die for groun.
I nor go look wetin dem don do kon trowey face,
but I go pay dem back
for dia sins and dia grand-grand papa own.
Dem don burn incense for juju hills
kon tok bad tins about mi.
So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”
God still sey,
“Nobody dey distroy good grapes,
instead, dem go use dem make wine.
And na so too I nor go distroy all my pipol,
but I go save doz wey dey serve mi.
I go bless Israel pipol wey kom from Judah tribe
and na dia shidren-shidren go stay my land.
My pipol wey I choose wey serve mi,
na dem go stay for der.
10 Dem go woship mi kon lead dia sheep and melu go chop grass for Sharon
and for Akor Valley for east.
11 But una wey nor dey obey mi;
wey don forget my holy mountin.
Wey prepare tabol for Gad wey bi Babilon god
kon mix drink for dat god wey dem dey kol Destiny,
wey dey give hope and luck to pipol,
12 una go die yeye deat,
bikos na so una wont am and una nor ansa wen I koll una
or listin wen I tok to una.
Una nor gri obey mi,
instead una kon dey do wiked tins.
13 I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi,
go get plenty food to chop and drink,
but food and wota go hongry una wey dey disobey mi.
My pipol go dey happy,
but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.
14 My pipol go sing dey happy,
but doz wey nor dey obey mi, go kry with pain.
15 Di pipol wey I choose go use una name as curse.
Mi, God wey bi king, go kill una.
But I go give new name to pipol wey obey mi.
16 Anybody for di land wey ask for blessing,
God wey dey faithful go bless am.
Anybody wey won swear,
go use God name wey bi trut take swear
and dis na bikos di trobol wey dey before,
don pass and I go forget dem forever.”
Di New Creashon
17 God sey, “I go kreate new heavens and new eart.
Nobody go remember di tins wey don happen
before and e go komot from dia mind kpata-kpata.
18 But make una dey happy forever,
bikos of wetin I go kreate.
Di new Jerusalem wey I go make,
na only joy go full am and en pipol go dey happy.
19 Joy go full my heart,
bikos of Jerusalem and en pipol.
Pipol nor go kry or feel pain for der again.
20 Small shidren nor go die again
and evribody go get long life.
Even wen pesin don rish hundred years,
dem go sey e still dey yong.
If dem die before dat time, e go bi sign sey,
I ponish dem.
21 My pipol go build house kon stay inside.
Dem go plant vine kon enjoy di fruit and di wine.
22 Anoda pesin nor go stay inside di house
wey dem build and odas wey nor plant,
nor go drink di wine wey my pipol make,
bikos my pipol go get long life like tree
and dem go enjoy evritin wey dem work for.
23 Dem go susid for di work wey dem dey do
and dia shidren nor go sofa.
I go bless dem and dia shidren-shidren forever.
24 Even before dem go pray to mi,
I go ansa dia prayers and as dem still dey tok,
I go hear dem.
25 Wolf and sheep go dey chop togeda;
lions go chop grass like melu,
while snake go chop san and dem nor go dey wiked again.
Nor-tin wey go kause wahala
or evil go dey for my holy mountin for Zion again.”