10
Peace Kon Dey
Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol. E lead Israel pipol for 23 years before e die and dem beri am for Shamir. Afta am, Jair wey kom from Gilead kon lead Israel for 22 years. E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village. Jair die and dem beri am for Kamon. Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
Jeftah
So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem. Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years. Ammon pipol cross Jordan River go fight Judah, Benjamin and Efraim tribe. And dis tin make Israel pipol weak well-well. 10 Den Israel pipol kon kry give God sey, “Wi don sin against Yu. Wi leave Yu kon dey woship Baal juju.”
11 So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia, 12 Sidon, Amalek and Maon pipol, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom save una from dia hand? 13 But una still leave mi kon dey woship oda gods, so I nor go save una again. 14 Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom save una wen una dey trobol.”
15 But Israel pipol tell God, “Wi don sin. So do us anytin wey Yu like, but today, wi dey beg sey make Yu kom save us.” 16 So dem skata all dia yeye gods kon bigin woship God; den God kon sorry for Israel pipol, bikos of dia sofa.
17 Ammon sojas kon ready to fight, so dem build dia kamp for Gilead. And Israel pipol gada kon kamp for Mizpa for Ramot. 18 For der, Israel pipol and di leaders kon dey ask demsef, “Who won lead us go fight Ammon pipol? Di pesin wey go lead us, go bi awa leader for Gilead.”