18
Mikaya And Dan Tribe
Dat time, Israel pipol nor get king.
And Dan tribe dey find where dem go stay, bikos dem neva fit pak go di land wey dem divide give dem, wen dem dey divide land give all di tribe for Israel. So Dan pipol choose five strong warrior from Zorah and Eshtaol town, so dat dem go find land where dem go stay.
Wen dis men rish Efraim hill kountry, dem kon go stay for Mikah house till di next day. As dem dey Mikah house, dem notis di Levi priest for der, so dem kon ask am, “Na who bring yu kom here? Na wetin yu dey do for here and wetin make yu dey here?”
E ansa dem, “I get agriment with Mikah, to bi en pesinal priest and e dey pay mi.”
Den dem tell am, “Ask God for us weda awa journey go get head.”
Di priest tell dem, “Make una go in peace, bikos God dey with una for di journey.”
So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.
Wen di men kom back to Zorah and Eshtaol, dia pipol kon ask dem, “Wetin una find?”
Dem ansa, “Make una kom, make wi attack dem! Wi don si di land and e dey very good. Wetin una dey wait for? Make wi nor waste time, make wi go take am. 10 Wen wi rish der, una go si sey di pipol dey leave eazy life. Di land big well-well and e get evritin wey pesin wont. God don gi-am to us.”
11 So six hundred men from Dan tribe wey ready for war kon komot go Zorah and Eshtaol. 12 Dem kamp for Kiriat-Jearim west for Judah and na dis make dem dey koll di place Dan till today. 13 Dem from der pass go Mikah house for Efraim hill kountry.
14 Den di five men wey go spy Laish land kon tell di oda pipol, “Dis house wey una dey si so, get holy garment and some oda juju wey dem karve, dey der too. Wetin una wont make wi do?” 15 So dem enter Mikah house where di yong priest dey stay kon greet am well. 16 As di six hundred men from Dan tribe wey ready to fight war, stand for di gate to enter di kompond, 17 di five men wey go spy, enter di shrine karry di image wey dem karve, di efod and di juju dem. While di priest stand for di gate with di six hundred men.
18 Wen di priest si sey di men dey karry di holy tins dey komot from di shrine, e kon ask dem, “Wetin una dey do so?”
19 Dem ansa am, “Kwayet and make yu follow us kon bi awa papa and priest. E nor good sey make yu bi priest for Israel tribe and family, down for one man?” 20 So di priest happy kon follow dem and e karry all di holy tins. 21 Dem kon dey go with dia shidren, animals and all wetin dem get.
22 Wen Dan pipol don go far from Mikah house, Mikah kon koll all en neighbours make dem follow am porshu Dan pipol. 23 Dem porshu Dan pipol katch. Den, Dan men turn back kon ask Mikah, “Wetin happen? Why yu koll all dis men make dem porshu us like dis?”
24 Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”
25 So Dan men tell am, “Mind wetin yu dey tok! Unless yu wont make all dis men attack kon kill yu and yor family.” 26 Den, Dan pipol kon waka dey go. Wen Mikah si sey di pipol too many for am to attack, e kon leave dem go back to en house.
27 Afta Dan pipol don take Mikah holy tins and priest, dem kon rish Laish land where di pipol dey kwayet well-well. Dem attack dem with swod kon burn di town rish groun. 28 Nobody dey to save dem, bikos dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor get any business with oda pipol.
Den, Dan tribe build di place kon dey stay der. And dis tin happen for di valley near Bet-Rehob. 29 Dem shange di town name from Laish to Dan, bikos of dia grand-grand papa wey bi Jakob pikin. 30 Den, dem arrange di juju kon make Jonatan wey bi Gershom pikin, dia priest and na Moses born Gershom. So na dat family bi priest until dem go Babilon. 31 So Mikah juju dey der, as long as God Tabanako dey for Shiloh.