20
Israel Ready For War
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa. Di leaders for all di tribe for Israel dey with God pipol too and dem bi 400,000 sojas. By dat time, Benjamin pipol don hear sey all di oda tribe for Israel, don gada for Mizpa. Israel pipol kon ask, “Make una tell us how dis bad tin take happen?”
So di Levi wey dem kill en girl-friend kon sey, “Mi and my girl-friend go spend one nite for Gibeah, wey bi Benjamin pipol town. Dat nite, some men for Gibeah kon surround di house won kon kill mi. Dem kon rape my girl-friend until e die. So I take en body, kut am into twelf part, den I send one-one go each tribe for Israel. Dis pipol don do evil and wiked tin. So naw, Israel pipol must decide wetin wi go do about dis tin!”
All di pipol get up di same time kon sey, “Non of us go-go house back! Dis na wetin wi go do Gibeah pipol; wi go pick pipol wey go attack dem. 10 Wi go still pick one out of evry ten from di men for each tribe, wey go dey supply di sojas food, den wi wey remain go attack Gibeah for Benjamin town, bikos of wetin dem do to Israel.” 11 So Israel pipol gada with one mind to go attack Gibeah town.
12 Israel pipol send message go Benjamin tribe sey, “Wetin bi dis wiked tin wey una do so? 13 Make una release doz wiked men, di trobol-makers from Gibeah, so dat wi go kill dem take klean Israel land from dis bad tin wey una do.”
But Benjamin pipol nor gri. 14 Instead dem komot from dia towns kon gada for Gibeah to fight Israel pipol. 15 Dem koll 26,000 sojas from all dia town and 700 special men wey dey stay der. 16 Di 700 men dey use left hand and each of dem dey stone without sey dem miss.
17 Israel pipol get 400,000 sojas wey dem don train.
18 Before dem go for di war, Israel pipol go Bethel go ask God, “Na wish tribe go first attack Benjamin pipol?”
God ansa, “Make Judah go first.”
19 So Israel pipol kwik komot for early morning go kamp near Gibeah. 20 Den dem mash go Gibeah go attack Benjamin men. 21 But Benjamin sojas wey dey guide di town kom kill 22,000 Israel pipol dat day. 22 Israel pipol enkourage each oda kon stay for di same place where dem for fight before. 23 Bikos dem don go Bethel go kry for God present till evening kon dey sey, “Make wi fight against awa rilative for Benjamin tribe again?”
God ansa dem, “Make una go fight dem.”
24 So di next day, dem kon go fight against Benjamin men, 25 but Benjamin men still kill anoda 18,000 Israel pipol wey sabi fight well-well.
26 Den all Israel pipol kon go Bethel again go kry and fast for God present till evening. Dem still bring burnt ofrin and peace ofrin kon give God. 27 Israel pipol kon dey ask for direcshon from God (bikos before-before, God Kovenant Box dey for Bethel 28 and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?”
God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”
29 So dem kon set trap round Gibeah. 30 Israel pipol kon attack Benjamin tribe for di third day and dem kamp for Gibeah just as dem do before. 31 Wen Benjamin pipol kom out kon fight, dem lead dem komot for di town. Just as before, dem bigin kill some Israel pipol, dem kill rish thirty Israel pipol for di open land and di road wey dem dey pass go Bethel and Gibeah.
32 Den Benjamin sojas shaut, “Wi dey win dem, just as wi do before!” But Israel pipol don plan before sey, dem go run komot from di town, so dat Benjamin men go porshu dem enter road.
33 Wen Israel main sojas rish Baal-Tamar, dem take dia pozishon, while di ones wey surround west for Gibeah rush kom out wons from where dem hide put kon attack. 34 Na 10,000 special sojas wey dem choose from Israel tribe kon attack Gibeah. Di fight strong well-well sotey Benjamin sojas nor know sey dem go soon distroy dem finish. 35 God help Israel pipol win Benjamin pipol and dat day, Israel pipol kill 25,000 men wey bi di best sojas for Benjamin tribe. 36 Den Benjamin sojas kon know sey, dem don luz.
Israel main sojas bin dey run from Benjamin sojas, bikos dem won give doz wey still hide for bush, di shance to attack Gibeah town. 37 Den doz wey hide, rush kom out kon kill evribody for di town. 38 Dem don arrange sey, dem go send big kloud of smoke from di town as signa. 39 Wen Israel pipol si di smoke, dem turn kon attack Benjamin sojas.
By dat time, Benjamin sojas don kill thirty Israel sojas, so dem kon sey, “Wi don dey win dem, just as wi do for di first fight!” 40 But wen Benjamin sojas look back kon si sey smoke dey go up from evriwhere for di town, 41 Israel sojas kon bigin attack dem. Naw, Benjamin sojas kon dey fear, bikos dem know sey, dem don die finish. 42 So dem turn kon dey run from Israel sojas go di open land, but dem nor fit eskape di fight and dem kill all di pipol wey kom out from di town wey dey near der too. 43 Israel sojas set trap for dia enemies and dem porshu dem sotey go rish Gibeah east kon dey kill dem as dem dey go. 44 Dat day, Benjamin 18,000 strong sojas die for di war. 45 Di ones wey manage survive run enter wildaness near Rimon Rock, but Israel sojas kill 5,000 for di road side. Dem porshu dem, until dem kill anoda 2,000 near Gidom.
46 So dat day, Benjamin tribe lost 25,000 strong sojas. 47 Di sojas wey remain na di six hundred wey run go Rimon Rock and dem stay der for four monts. 48 Israel pipol still go back go kill Benjamin pipol wey remain; di men, wimen, shidren and even all di animals. Dem burn all di towns for der.