14
Di Last Tin Wey Jesus Tell En Disciples
“Make una nor let anytin worry una mind. Since una bilive God, make una still bilive mi. Many rooms dey for my Papa house and I dey go prepare place for una to stay, if nor bi so, I for tell una. Wen I don finish, I go kom take una, so dat una go stay with mi for where I dey. And una go know di place wey I dey go and how una go take rish der.”
Tomas ask am, “Oga God, wi nor know where yu dey go, how wi go take know road?”
Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi. But since una don know mi, una go know my Papa too. Naw wey una don know am, una don si am.”
Filip kon sey, “Oga God, show us yor Papa and wi go dey okay.”
Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’ 10 Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi. 11 Make una bilive sey I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi, but if una nor fit bilive mi, make una bilive bikos of di mirakles wey I dey do. 12 I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa. 13 And anytin wey una use my name ask, I go do am, so dat pipol go honor di Papa bikos of en pikin. 14 If una ask anytin with my name, I go do am for una.
Di Holy Spirit
15 “If una love mi, una go do wetin I tok. 16 Den I go ask my Papa and E go send una anoda Pesin wey go help and stay with una forever. 17 Naim bi di Spirit wey dey tok trut, wey pipol for dis world nor go fit receive, bikos dem nor fit si am or know am, but una know am, bikos e dey stay inside una. 18 I nor go leave una like pikin wey nor get papa and mama, bikos I go kom meet una again. 19 Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too. 20 Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una. 21 Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”
22 Judas (dis nor bi Judas Iskariot) kon sey, “Oga God, why yu won show yorsef give us and yu nor won show oda pipol for di world?”
23 Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am. 24 Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.
25 “I don dey tell una all dis tins since I dey with una. 26 But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom for my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una. 27 Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.
28 “Una remember wen I tell una sey, ‘I dey komot and I go kom back kon meet una?’ If una love mi, una go happy wen I tok sey, ‘I dey go meet my Papa’, bikos my Papa big pass mi. 29 I don tell una naw before e happen, so dat wen e happen, una go bilive mi. 30 I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body. 31 Since I dey do wetin my Papa tell mi, di world go know sey I love my Papa.
“So make una get up make wi dey go.