14
Rain Nor Go Fall
Dis na wetin God tell Jeremaya about rain wey nor go fall.
“Judah dey mourn and en pipol dey die anyhow;
en pipol sleep for groun dey kry.
Yes, Jerusalem pipol dey kry for help.
Rish pipol send dia savant go fetch wota for well,
but dem nor si wota fetch,
so dem kom back with dia empty kontaina.
Dem kover dia face,
bikos dem dey shame and dey konfuse.
Rain nor fall since so dia land dey strong
and doz wey dey plant, don taya
and dem nor know wetin to do.
Even deer dey waka
leave di pikin wey e just born for field,
bikos e nor si grass chop.
Wiked donkey stand on-top hill
dey breath fast-fast like jackals;
dem nor dey si well again,
bikos dem nor si food chop.”
Den I ansa,
“My God, even doh awa sins dey tok against us,
make Yu kom save us
bikos of di honor for yor name.
True-true, wi don turn from Yu
many times and sin against Yu.
Yet, na Yu bi di only hope wey Israel get;
na Yu save us from wahala.
So naw, why Yu kon bi like strenja for awa land
or like pesin wey dey travel
kon branch stay for one nite?
Why Yu bi like pesin wey nor know before dem attack am
or like sojas wey nor fit save pesin?
But my God, Yu still really dey with us!
Wi bi yor pipol, abeg,
make Yu nor abandon us.”
10 God tok about dis pipol sey:
“Dem dey run from mi
and dem nor dey kontrol demsef.
So, I nor dey happy with dem.
I go remember all di bad-bad tins
wey dem don do kon ponish dem,
bikos of dia sin.”
11 God tell mi, “Nor beg mi sey, make I help dis pipol. 12 Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
13 Den I sey, “My Oga God, di profets tell di pipol sey, ‘Una nor go si war again and honga go vanish from una land. God go give una peace forever and una go prosper for di land.’ ”
14 But God ansa, “Doz profet dey lie with my name; I nor send dem or tell dem sey make dem tell di pipol anytin. Nor bi mi give dem di vishon wey dem dey tok about and wetin dem tok, na di yuzles tins wey dem tink for dia own mind. 15 I nor send doz profets, even doh dem dey lie with my name. Dem fit dey sey, ‘War and honga nor go dey for di land.’ But dis na wetin mi wey bi Oga God dey tok about dem: ‘Na war and honga go kill doz profets.’ 16 And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”
17 God sey make I tell di pipol dis word:
“I dey kry both day and nite
and nor-tin fit stop mi,
bikos my pipol don wound
and dia sore deep well-well.
18 Anytime I dey strol outside di town,
doz wey dem kill for war,
na dia dead body I dey si for road
and wen I enter di town,
I go still si sey pipol dey die,
bikos dem nor si food chop.
Profet and priest dey do dia work,
but dem nor know wetin dem dey do.”
19 Den I sey,
“My God, Yu don forget Judah pipol?
Na so Yu hate Zion town?
Wetin make Yu dey do us like dis,
sotey wi nor dey okay again?
Wi dey hope for peace,
but na wahala wi dey si.
Wi dey bilive sey wi go well,
instead na trobol dey follow us.
20 Wi don sin against Yu wey bi God;
so wi dey konfess awa sins
and di ones wey awa grand-grand papa dem kommit.
21 Make Yu remember yor promise and nor hate us.
Nor disgrace Jerusalem,
di place wey yor throne wey get glory, dey.
Abeg, make Yu nor break di kovenant
wey Yu make with us.
22 Just as no one among di juju
for dis nashon fit bring rain,
na so too di sky
nor fit make rain fall by ensef.
So wi don put awa hope for yor hand.
Na Yu bi awa God,
bikos na only Yu fit do all dis tins.”