23
New Leaders
“E go bad well-well for doz leaders wey suppose kare for my pipol just as shepad dey kare for en sheep, but dem nor do am, instead dem distroy and skata my pipol. Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do. I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side. I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again.
Mi, wey bi God, don tok.”
God sey, “Di time dey kom
wen I go choose betta king
from among David shidren-shidren.
E go rule di land with wisdom
kon do wetin dey korrect and good.
Wen e bikom king, Judah pipol go dey save
and Israel pipol go stay for peace.
Dem go koll am,
‘Na God bi awa raitiousness.’ ”
God sey, “Di time dey kom, wen pipol nor go use my name take swear sey, ‘Yu bi God wey dey alive wey take Israel pipol komot from Egypt.’ Instead dem go sey, ‘Yu bi di God wey dey alive wey bring Israel pipol kom back from di land for nort and from di oda kountries wey Yu skata dem go.’ For dat time, dem go dey dia own land.”
Lie-lie Profet
Dis na wetin God tok about lie-lie profets:
“Dem don break my heart
and all my body dey shake.
I bi like pesin wey don drink wine well-well,
bikos of di wey dem dey trit mi
and my holy word.
10 Na pipol wey nor dey faithful,
full di land
and dem dey live wiked life
kon dey use dia pawa anyhow.
Di pipol dey mourn and all di green leaf don dry,
bikos God don curse dia land.”
11 God sey,
“Di profets and priests nor know mi;
I katch dem dey do wiked tins for my temple.
12 So di road wey dem dey pass,
go dark and go dey draw;
I go make dem kick stone fall.
I go bring wahala kom meet dem
and di time to ponish dem, don near.
Mi, wey bi God, don tok.”
13 God sey,
“I dey si di sins wey Samaria profets dey kommit;
dem dey profesai with Baal name
kon lead my pipol komot from di trut.
14 But I si sey na Jerusalem profets own worse pass;
dem dey sleep with who dem nor marry;
dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins,
so dat dem nor go stop to live dia wiked life.
To mi, all of dem bad and wiked
like Sodom and Gomorrah pipol.
15 So, dis na wetin mi wey bi God dey tok
about Jerusalem profets:
‘I go give dem bitter food chop
kon give dem wota wey dem poizin, drink,
bikos dem don spread sin for di whole land.’ ”
16 God wey dey mighty still tell Jerusalem pipol:
“Make una nor listin
to wetin doz lie-lie profets dey tell una;
na yeye hope dem dey give una.
Nor bi wetin I tell dem,
dem dey tell una,
but na wetin dem tink and like,
dem dey tok.
17 Pipol wey nor gri listin to wetin God tok,
dem dey tell dem sey,
‘Evritin go-go well with una!’
And dem dey tell sturbon pipol sey,
‘Bad tins nor go happen to una at-all!’
18 So, I sey, Nobody among dis profets
know wetin God dey tink for sekret.
No one don ever hear
or undastand en message
or listin to wetin E tok.
19 But just look, God vexnashon go kom like heavy breeze
and e go blow wiked pipol head komot.
20 E nor go end until E don do evritin wey E plan to do.
Di time dey kom wen di pipol go undastand all dis tins well.”
21 God sey,
“I nor send all dis profets,
but dem dey rush go tok dia own message.
I nor tell dem anytin,
but dem still dey profesai.
22 How I wish dem know wetin I dey tink for my mind,
den dem for fit prish my message give my pipol,
so dat dem go stop di kind life
wey dem dey live
and di bad-bad tins wey dem dey do.
23 Abi una tink sey I bi God
wey dem tie put for one place?
No! I dey evriwhere.
24 E nor get where pesin go hide
put make I for nor si am.
Yu nor know sey I dey evriwhere
for di heavens and di eart?
25 “I know evritin wey doz profets tok; dem dey lie with my name sey I tok to dem thru dreams. 26 How long e go take for doz profets to stop to dey deceive my pipol with dia lie-lie word? 27 Dem tink sey di dream wey dem dey tok so, go make my pipol forget mi, just as dia grand-grand papa forget mi kon dey follow Baal? 28 Make di profet wey dream, tok only wetin e dream and make di profet wey hear my message, tok di trut. Nobody fit use tree kanda kompare di main tree. 29 My message bi like fire and na hammer wey dey break rock into pieces. 30 I hate all doz profets wey dey listin to oda profets words kon tell my pipol sey na mi tok am. 31 I still dey against doz profets wey dey tok dia own word kon sey na mi tell dem. 32 Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all.
Mi, wey bi God don tok.”
33 God tell mi, “Jeremaya, if anybody among my pipol, or profet or priest ask yu, ‘Wetin God tok?’ Make yu tell dem sey, ‘Una dey disturb God and E go distroy una.’ 34 I go ponish anybody, profet or priest wey sey, ‘God message na wahala!’ I go ponish di pesin and all en family.”
35 So mi, Jeremaya dey tell una sey, “Make una dey ask una friend or relashon, ‘Wish ansa God give and wetin God tok?’ 36 So make una nor sey God message na wahala, bikos if anybody tok like dat, den di message go bi wahala to am. Di pipol don shange dia God; di Almighty God wey dey alive, dem don shange en word. 37 So Jeremaya, ask di profets, ‘Wish ansa God give una or wetin God tok?’ 38 But if dem nor obey my kommand kon sey, ‘God message na wahala,’ den yu go tell dem sey, 39 ‘God go trow una far from am; both una and di town wey E give una and una grand-grand papa.’ 40 I go disgrace dem forever and dem nor go forget am.”