31
Israel Pipol Go-go Back To Dia Land
God sey,
“For dat time, all di tribe wey dey Israel,
na mi go bi dia God and dem go bi my pipol.
Doz wey still dey alive, I go sorry
and favor dem wen dem dey desert.
I go give Israel pipol peace for dia mind.
I go kom help dem, bikos I love Israel pipol well-well
and na dis make mi still dey show dem
my love wey nor dey end.
I go build una again and una go take una sheke-sheke
kon dance and dey happy again.
Una go plant vineyard on-top Samaria hill again
and di pipol wey plant dem, go chop from dem.
Yes, di time dey kom wen doz wey dey guide di gate
go koll from Efraim hill sey,
‘Kom make wi go Zion
go woship di Oga wey bi awa God.’ ”
God even sey,
“Make una sing and happy for Israel pipol;
make una happy for di nashon wey great well-well.
Make dem hear una praiz for evriwhere kon sey,
‘God, make Yu save yor pipol,
diliver Israel pipol wey remain.’
Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon
gada dem from evry part for di eart.
Doz wey blind; wey nor fit waka;
wimen wey get belle and doz wey won born,
go follow dem kom back too.
Dem go kom back as one great nashon.
As I dey lead dem kom back, dem go dey kry,
beg and pray make I forgive dem.
I go guide dem pass where wota dey
kon take dem pass strait road
where dem nor go kick stone fall.
I go do am, bikos na mi bi Israel papa
and Efraim na my first-born.’ ”
10 All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok,
den una go-go tok about am for far land
wey dey near di sea sey,
“Just as shepad dey guide en sheep,
na so too God wey skata en pipol,
go gada and guide dem again.
11 God go free and save Israel pipol
from strong nashons wey dey opress dem.
12 Bikos of di gift wey God give dem wey bi;
korn, wine, olive oil, sheep and melu,
dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion.
Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well
kon get evritin wey dem wont.
13 Den di yong wimen go sing with joy,
while di yong and old men, go dey happy.
I go konfort dem kon turn dia kry to joy
and dia sorrow go bi happiness.
14 I go give good food to dia priests
and my pipol go get evritin wey dem wont.
Mi, wey bi God, don tok.”
God Sorry For En Pipol
15 God sey,
“Pipol hear kry and shaut for Rama.
Rashel dey kry for en pikin dem wey don die
and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”
16 But naw, dis na wetin God dey tok,
“Make yu nor kry again, bikos I go reward yu.
Yu shidren go kom back from dia enemies
land kom meet yu.
17 True-true, yu get hope about yor tumoro
and yor shidren go kom house back.
Mi, wey bi God, don tok.”
18 I hear Israel pipol dey tok with pain sey,
“Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train,
but Yu don tish us to dey obey.
So make Yu bring us kom back,
bikos wi dey ready to kom meet Yu
di Oga wey bi awa God.
19 Before, wi sin against Yu,
but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu.
Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again.
Di sin wey wi sin wen wi dey yong,
dey make us dey shame.”
20 So God ansa,
“Israel, una bi my shidren wey I love well-well.
I dey always tink of una with love
wen ever I remember una name.
Una dey for my heart
and I go really sorry for una.
21 So make una mark di road,
so dat una go know where una pass
wen dem dey karry una go Babilon.
Israel pipol, make una kom back to di town
wey una run leave.
22 Pipol wey nor bilive, na wen una go stop to waste una time?
Mi wey bi God promise to bring new tin kom dis eart
and e go dey special
like wen woman dey protet man.”
God Pipol Go Prosper
23 Israel God wey dey rule evribody sey,
“Wen I don bring di pipol kom back to dia land,
dem go tok for Judah sey,
‘Make God bless Jerusalem hill;
di holy place wey E dey stay.’
24 Pipol go stay for Judah and all en towns;
farmers go dey evriwhere
and shepad go dey to guide dia animals.
25 Doz wey don taya, I go give dem wota drink
kon feed doz wey don weak bikos of honga.
26 Den pipol go sey,
‘Wi sleep in peace and wake-up in peace.’ ”
27 God sey, “Di time dey kom wen I go make pipol and animals full Israel and Judah land again. 28 And just as I make sure sey dem rut, pul, ova-trow, distroy and skata dem, na so too I go make sure sey dem plant and build dem back again.
29 “Wen dat time rish, pipol nor go sey, ‘Papa and mama chop grape wey nor ripe, but na dia shidren tit dey pain dem.’ 30 Instead, di pesin wey chop grape wey nor ripe, na en own tit go dey pain am and e go die bikos of en own sin.”
31 God sey, “Di time dey kom wen I go make new kovenant with Israel and Judah pipol. 32 E nor go bi like di old kovenant wey I make with dia grand-grand papa, wen I karry dem komot from Egypt. Even doh I bi like dia husband, dem nor gri keep di kovenant wey wi make. 33 Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
34 “Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before.
Mi, wey bi God, don tok.”
35 God don promise Israel pipol sey,
“E go give dem sun as lite for day time,
while di moon and star go dey shine for nite.
E sey, E go shake di sea
and di wave go roll on-top each oda.
En name na God wey dey mighty.”
36 God promise sey,
“As long as di world dey, na so too,
Israel go bi my nashon forever.”
37 Dis na wetin Oga God tok:
“Just as nobody go fit measure di heavens
or open di eart foundashon,
na so too I nor go ever rijet Israel pipol
bikos of wetin dem do.
Mi, wey bi God, don tok!”
38 God sey, “Di time dey kom wen dem go ribuild evriwhere for Jerusalem wey bi my town; from Hananel Towa for west go rish Korna Gate. 39 And di boundary go kontinue from west go rish Gareb Hill kon turn go Goah. 40 All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”