39
Jerusalem Fall
For di tent mont inside di ninet year wen Zedekaya bi king for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kom attack Jerusalem with en sojas. Babilon sojas break enter Jerusalem for di ninet day for di fourt mont wen Zedekaya don dey rule for eleven years. Wen dem attack Jerusalem, Babilon sojas go pozishon demsef for di Middle Gate and Nergal-Sharezer wey kom from Samgar, Sarsechim and anoda Nergal-Sharezer wey bi senior ofisas dey among dem too. Wen King Zedekaya and all en sojas si wetin dey happen, dem kon try to run komot for di town for nite. Dem pass di gate wey join di two wall for back near di king gardin kon go Jordan River Valley. But Babilon sojas porshu dem kon katch Zedekaya near Jeriko. Den dem take am go meet King Nebukadnezzar for Riblah town wey dey Hamat land and na for der Nebukadnezzar for judge am. Dem force Zedekaya make e dey look as dem dey kill all en shidren and en ofisas for Riblah. Afta dat one, dem blind Zedekaya eye kon tie am with shain, den dem karry am go Babilon. By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall. Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas. 10 But e leave some poor pipol kon give dem vineyard and farm, so dat dem go dey work for der.
Dem Release Jeremaya
11 But King Nebukadnezzar kommand Nebuzaradan wey bi di sojas oga sey make e go find Jeremaya kom. 12 E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.” 13 So Nebuzaradan, with some big ofisas wey bi Nebushazban, Nergal-Sharezer with all di oda Babilon king offisa 14 kon bring mi kom di palis kourtyard. Dem sey make Gedalaya wey Shafan pikin Ahikam born, kare for mi and make sure sey I rish house well. So I kon stay my house for Judah with di pipol wey remain.
15 Wen I still dey prison for di palis, God tell mi 16 sey make I tell Ebed Melek wey kom from Ethiopia sey, “Israel God wey dey mighty sey, ‘Just as I promise, I go distroy dis town and nor-tin go remain.’ And yu go si am wen e dey happen. 17 But mi, wey bi God go protet yu from di pipol wey yu dey fear. 18 I go save yu and dem nor go kill yu. Yu go eskape with yor life, bikos yu trust mi.
Mi, wey bi God, don tok.”