46
Judgement For Egypt
God tok to mi about di nashons.
Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.
Egypt offisa dey shaut,
“Make una ready una weapon kon mash go fight!
Make una ready and klimb una horse!
Make una take pozishon kon wear una helmet!
Den sharp una spear kon wear una war klot!”
But God ask, “Na wetin I dey si so?
Dem dey turn back, bikos of fear.
Babilon sojas win dia sojas and dem kon run.
Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.
Even di sojas wey sabi run well-well,
nor fit eskape.
Wen dem run rish di nort side for Eufrates River,
dem stagga kon fall.
Who bi dis wey dey flow kom like River Nile;
like river wey en wota dey rush enter land?
Na Egypt dey flow like River Nile;
like river wey dey rush enter land.
Egypt sey, ‘I go kover di world;
I go distroy many towns and di pipol wey dey stay inside.
Make una kommand di shariot make dem go!
Make una send sojas from Ethiopia, Libya and Lydia.
Men wey fit fight with shield and bow.’ ”
10 Na God wey dey mighty get today.
Today, E go take revensh kon ponish all en enemies.
En swod go kill all of dem.
God wey dey mighty don sakrifice doz
wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.
11 Egypt pipol! Make una go Gilead go find medicine,
but all una medicine nor go work and nor-tin go fit heal una.
12 Oda nashons don hear of una shame
and evribody don hear una kry.
One soja fall press anoda one
and unasef don fall rish groun.
Nebukadnezzar Dey Kom
13 Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,
14 “Make yu shaut am for Egypt,
Migdol, Memfis and Tahpanhes sey,
‘Make una ready to defend unasef,
bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’
15 Wetin make una mighty god wey dem dey koll Apis, fall? Na God strike am.
16 Una sojas don fall! Dem dey tell each oda sey,
‘Make wi hurry go house go meet awa pipol,
before awa enemies go kill us finish!’
17 For der, dem go sey, ‘Make una give Egypt king new name,
bikos e too make nois and na dis make am miss all en shance.’
18 Mi, God wey dey mighty, I bi king.
Na mi bi di God wey dey alive.
As Mount Tabor high pass di mountins
and Mount Karmel high pass di sea,
di enemies wey dey kom attack una,
na so dia pawa bi.
19 Egypt pipol, make una ready to go Babilon as slaves!
Dem go turn Memfis to desert
and e go bi dirty land where nobody dey stay.
20 Egypt bi like fine melu,
but sojas from nort go kom attack am
like wiked fly wey dey bite pesin.
21 Even di sojas wey dem hire lazy like small goat.
Instead make dem stand fight,
na run dem dey run.
Di day for dem to face wahala and ponishment,
don kom.
22 Wen Egypt pipol si dia enemies dey kom,
dem run kon dey hiss like snake.
Dia enemies attack dem with axe
like pesin wey dey kut tree
23 or klear tick forest.
Dia men too many to kount
and dia sojas many pass ant.
24 Dem disgrace Egypt pipol
and na doz from nort win dem.
Mi, wey bi God, don tok.”
25 Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am 26 give King Nebukadnezzar and en sojas wey won kill dem. But afta, pipol go stay for Egypt again, as dem do before.
Mi, wey bi God, don tok.
God Go Save En Pipol
27 “So make my pipol, Israel nor fear!
Make una heart nor shake.
I go save una from dat land wey far
wey una for bi prisonas.
Una go kom back to una land
kon stay for peace.
Una go dey save
and nobody go make una fear again.
28 I go kom meet and save una.
I go distroy all di nashons where I skata una go,
but I nor go distroy una.
I go must ponish una,
but I go do am to korrect una.
Mi, wey bi God, don tok.”