48
Message About Moab
Dis na wetin God tok about Moab pipol:
“Betta wahala dey kom meet Nebo pipol,
bikos dem don distroy and seize Kiriataim town.
Dem don skata en strong wall
kon make di pipol dey shame.
Pipol nor go praiz Moab again.
Enemies don seize Heshbon land
kon plan as dem go take distroy Moab town.
Dem go distroy Madmen town too
and na wiked sojas go mash kom skata am.
Horonaim pipol dey kry sey,
‘War don Kom! Dem don distroy us finish o-o!’
Dem don distroy Moab!
Make una hear as en shidren dey kry.
Make una hear dia kry for di road wey dem dey pass go Luhit.
Dem dey kry with pain as dem dey go Horonaim.
Dem sey, ‘Make una kwik-kwik run for una life!
Make una run like donkey for desert!’
Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get,
but naw, yu go die
and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god,
en prince and priests,
go anoda land.
Doz wey dey distroy go distroy evry town.
E nor get any town wey go eskape.
Dem go distroy di town dem wey dey di valley
with doz ones wey dey di hill too.
Mi, wey bi God, don tok.
So make una build grave for Moab,
bikos dem go soon distroy am.
Dem go skata di town
and nobody go stay der again.”
10 (Pesin wey nor do God work with all en heart,
na curse go follow am
and na di same curse go follow
who nor bring en swod kom out to take kill!)
Dem Distroy Moab
11 God sey, “Moab pipol dey always stay for peace
and dem neva ever karry dem go do slave work.
Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun;
wine wey dem nor dey pour from cup to cup.
Yes! Di wine still sweet
and en taste still good as e bi before.
12 But di time dey kom wen I go send pipol go pour Moab pipol,
just as dem dey pour wine.
Di wine pot for Moab go empty
and dem go break di pot to pieces.
13 Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel,
na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.
14 Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa
or sey una strong well-well for war?
15 Dem don distroy Moab town and all en pipol;
all di fine yong men for der,
dem don kill dem finish.
Na mi bi di king, di God wey dey mighty, and I don tok.
16 Di time wen dem go distroy Moab land don near
and di wahala go soon start.
17 Una wey dey stay near dat nashon,
make una mourn for am.
Yes! All of una wey know en glory.
Make una sey, ‘Si as en strong pawa don break;
en glory and en pawa nor dey again.’
18 Yu wey dey stay for Dibon,
kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san;
bikos di pesin wey distroy Moab
and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.
19 Yu wey dey stay Aroer,
make yu stand for road kon look well;
den ask di pipol wey dey run, wetin dey happen.
20 Dem go ansa, ‘Moab don fall!
Make una kry for am,
bikos dem don disgrace am.
Make una shaut near Arnon River sey,
“Moab don skata!” ’
21 “Judgement don kom di towns wey dey up and dem bi: Holon, Jahza, Mefaat, 22 Dibon, Nebo, Bet-Diblataim, 23 Kiriataim, Bet-Gamul, Baal-Meon, 24 Keriot and Bozrah: judgement don kom meet di towns wey dey Moab: both di ones wey dey far and di ones wey dey near. 25 Dem don break and distroy Moab pipol pawa.
Mi, wey bi God, don tok.”
26 God sey, “Make Moab stagga kon fall like pesin wey don drink,
bikos dem go against mi.
Moab go roll on-top en vomit
and pipol go laf am.
27 Moab pipol, hope una remember how una take laf Israel pipol?
Una trit dem like sey dem bi tif.
28 Una wey dey Moab, make una komot from town
go stay for under rocks!
Make una bi like dove wey dey build en house on-top rock.
29 Moab pipol too dey proud!
I don hear as dem proud and sturbon rish
and how dem dey tink of demsef alone.
30 Mi wey bi God, I know as dem dey karry body.
Dem just dey boast for nor-tin
and all di tins wey dem dey do, nor go last.
31 So, I go kry for doz
wey dey Moab and Kir-Hareset.
32 I go kry well-well for Sibmah and Jazer pipol.
Sibmah town, yu bi like vine wey en branches rish Dead Sea
den kon go Jazer town.
But naw, yor fruit and grape wey yu plant for dry sizin,
don skata.
33 Di happiness and joy wey dey Moab land,
don vanish.
I don make dia wine stop to flow from di winepress.
Nobody dey to make wine for dem
and una nor go hear happiness nois from der again.
34 Heshbon and Elealeh pipol kry well-well
and dem hear dia kry
for Jahaz, Zoar, Horonaim and Shelishiyah town.
But Nimrim river, don dry.
35 I go stop Moab pipol make dem nor dey burn ofrin
for where dem for dey woship and offa sakrifice give dia gods.
Mi, wey bi God, don tok.
36 So I dey kry from my heart for Moab and Kir-Heres pipol
like pesin wey dey blow trumpet and sing burial song,
bikos evritin wey dem get, don vanish.
37 All of dem don shave dia hair and barber dia bear-bear.
Dem wear sak kon kut dia hand,
so dat di marks go show sey dem dey mourn.
38 On-top Moab house and for di meetin place,
na only pipol wey dey mourn and kry dey der,
bikos I don break Moab like pot wey pipol
nor won use again.
39 Moab don skata! Make una kry well-well,
bikos dem don disgrace Moab.
Di town don skata and all di nashon wey dey round am,
dey laf am.
Mi, wey bi God, don tok.”
40 God don promise sey, “One nashon go rush
kom Moab land like eagle wey spread en feada
41 and dem go seize di town and all en strong building.
For dat day, Moab sojas go dey fear like woman wey won born.
42 Moab go skata and nobody go know am again,
bikos God don curse am.
43 Wahala, pit wey dem dig and trap wey dem set,
dey wait for Moab pipol.”
Na so God don tok.
44 God still sey,
“Anybody wey try eskape di wahala
go fall enter di pit
and anybody wey fit kom out from di pit
go enter trap,
bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.
45 Pipol wey nor get house kon find help go Heshbon,
di town wey King Sihon dey rule before,
but fire don burn di town.
Fire don burn doz
wey dey give Moab pipol hope.
46 Curse dey Moab land!
Di pipol wey dey woship Kemosh don skata
and di enemies don karry dia shidren go as prisonas.
47 But di day dey kom wen God go make Moab prosper again.
Dis na wetin God sey go happen to Moab land.”