51
God Distroy Babilon
God sey,
“I go distroy Babilon and en pipol
with strong breeze.
I go send strenjas kom distroy Babilon
like breeze wey blow dirty trowey.
Wen dat day rish, dem go attack dem from difren side,
until di land go empty.
Dem nor go give Babilon sojas time to even shot arrow
or wear dia war klot.
Dem nor go sorry for Babilon yong men
and dem go distroy all dia sojas.
Dem go wound kon fall die for all di street
wey dey dia towns.
Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol,
even doh dem sin against mi wey bi di holy God for Israel.
So, make una run komot Babilon town!
Make una run for una dear life!
Make una nor die for nor-tin,
bikos of Babilon pipol sin.
I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.
Babilon pipol bi like gold cup for my hand a
nd di wine for inside dey shark di whole world.
Di nashons drink from am
and dem kon start to bihave anyhow.
But na wons Babilon fall kon skata.
Make una mourn for am!
Make una find medicine for am,
may bi dat one fit cure am.
Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town,
but e don too late.
Make wi leave am kon go back to awa house,
bikos God don ponish Babilon pipol
kon distroy di town.’ ”
10 God sey,
“My pipol, make una shaut sey:
‘God don show sey wi dey do di rite tin.
So make wi go tell doz wey dey Jerusalem
wetin God do for us.’
11 So God go use Media kings take distroy Babilon.
E go revensh bikos of en temple
wey Babilon sojas distroy.
Media sojas oga kon kommand sey,
‘Make una sharp una arrow and karry una shield!
12 Make una give sign make dem go attack Babilon.
Give di guide pawa kon put dem for dia pozishon,
den una go hide some men for bush too!’
God don do wetin E sey E go do to Babilon pipol.
13 Una wey dey stay along Babilon river,
una end don near well-well.
Una wey rish well-well with propaty wey una tif,
dis na di time to kill una.
14 God wey dey mighty, don swear with ensef sey,
E go bring many pipol kon attack Babilon like ant
and dem go shaut dey happy.”
Dem Sing Hymns Take Praiz God
15 God make di eart with en pawa;
na en wisdom E take kreate di world
kon spread di heavens with en sense.
16 Wen E kommand, di wota on-top sky dey make nois
like wen lion dey shaut.
E make di kloud kom out from di rite place.
E make lite kom out for rainin sizin
kon send breeze kom from where E keep dem put.
17 Wen pipol si dis tins, dem dey bi like fool
wey nor get sense.
Doz wey dey make juju, na di juju dey disgrace dem;
di gods wey dem make, nor bi betta god
and e nor even get life.
18 Dem dey yuzles and pipol dey use dem make yeye.
Den wen di time rish, God go distroy all of dem.
19 Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin
and E don choose Israel as en own pipol.
Na God wey get pawa, bi en name.
God Hammer
20 God sey,
“Babilon pipol, una bi my hammer and swod
wey I dey use take fight.
I use una take skata nashons and kingdoms.
21 I still use una take
skata horse, shariot and di pipol wey dey ride dem.
22 Na so too, I use una take kill men and wimen;
kut both old and yong pipol and kill boys and girls too.
23 I still use una take kill shepads and dia animals;
kill pipol wey dey tif and dia horse;
den skata rulers and ofisas.
24 But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol
for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.
25 Babilon! Yu bi like mountin wey distroy di whole world,
but mi wey bi God, na una enemy.
I go katch, skata and burn una to ashes.
26 Di stone wey skata for una town,
una nor go fit use am take build house again.
Una go bi like desert forever.
27 Make una give dem sign to attack!
Make una blow trumpet, so dat di nashon go hear!
Ready di nashons, so dat dem go fight against Babilon pipol!
Tell Ararat, Minni and Ashkenaz kingdom
make dem attack Babilon.
Make una choose one offisa wey go lead dem go attack
and bring all di horse kom back like many ant.
28 Prepare di nashons make dem go fight against Babilon pipol.
Send messenjas make dem go koll Media kings,
dia leaders, ofisas and di sojas
for all di kountries wey dem dey kontrol.
29 Di eart dey fear and shake,
bikos God dey do wetin E plan
wen E sey E go turn Babilon to desert
where pipol nor dey stay.
30 Babilon sojas don stop to fight
and dem dey for dia tent.
Dem nor get hope again
and dem don weak like woman.
Dem don break di town gate for groun
kon burn all di house with fire.
31 Difren messenjas go run go tell Babilon king sey
dem don break en town enter from difren korna.
32 Enemies don seize di river wey dem dey pass
kon burn all dia strong and betta house
and Babilon sojas dey fear well-well naw.
33 E nor go tey before enemies go kut dem for groun
like korn wey dem dey pick for farm.
Mi, wey bi Israel God wey dey mighty, don tok.
34 King Nebukadnezzar for Babilon don skata,
chop and distroy my town like empty cup.
E swallow am like wiked animal
and na awa propaty full en belle.
E still porshu us komot from awa own land.
35 Zion pipol sey, ‘Just as Babilon pipol sofa us,
na so too God go sofa dem
and make God pay dem back,
bikos dem kill awa pipol.’ ”
God Go Help Israel
36 Dis na wetin God tell Jerusalem pipol:
“I go bi una lawyer kon judge una kase,
den I go fight for una.
I go dry Babilon rivers.
37 Babilon go turn where dem dey trowey dirty put
and trobol go dey follow am.
Pipol go fear and hate dem
and nobody go stay der again.
38 En pipol go shaut like lion wey dey find food;
like lion shidren wey dey hongry.
39 As dem dey hongry, I go prepare food,
so dat dem go chop and drink kon happy.
Den dem go sleep kon die go like dat.
40 I go karry dem
go kill like lamb, goats and rams.”
41 God tok about Babilon sey:
“Dem don seize di town wey di whole world dey praiz!
Naw, e don turn where nashons dey fear to stay.
42 Di sea rush enter Babilon
and naw e don kover di town.
43 Di town don turn where pipol dey fear to stay
and e bi like desert wey nor get wota;
where pipol nor dey stay or travel pass.
44 I go ponish Bel wey bi Babilon god
and make am drop all di tins wey e tif
and di nashons nor go woship am again.
Naw, Babilon wall don fall.
45 So Israel pipol, make una run komot from der!
Make una run for una dear life and from my vexnashon.
46 Make una nor fear or luz hope,
bikos of wetin una hear.
Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land
and dem go sey one king dey fight anoda one.
47 So di time dey kom wen I go deal with Babilon juju.
Di whole kountry go shame and dem go kill all en pipol.
48 Den evritin wey dey heaven and eart go dey happy
wen Babilon pipol go fall,
wen doz sojas from nort don distroy dem.
49 Na Babilon kill many pipol for dis world.
Yes! Babilon go fall,
bikos na-im make many Israel pipol die.
Mi, wey bi God, don tok.”
50 God tell en pipol wey dey Babilon,
“Una don eskape deat!
So make una dey go and nor wait!
Even doh una dey far from una land,
make una tink about mi
wey bi una Oga God
and una go remember Jerusalem.”
51 Di pipol sey, “Wi dey shame,
dem don insult and disgrace us,
bikos strenjas don dirty God temple.”
52 God sey,
“Yes! Di time dey kom
wen I go distroy all Babilon juju
and for evriwhere for di land,
dem go dey hear doz wey wound dey kry
bikos of dia pain.
53 Even if Babilon klimb go sky
kon build strong house for der,
I go still send pipol go distroy am.
Mi, wey bi God, don tok.”
54 God sey,
“Make una listin as dem dey kry for Babilon town.
Dem dey mourn, bikos of how dem distroy di land.
55 I go distroy Babilon and nobody go hear en vois again.
Sojas go rush kom attack dem like wota for sea and dem go sey,
56 ‘Wi don distroy Babilon.
Wi don seize en sojas kon break dia bow.’
I bi di God wey dey ponish bad pipol
and I go pay Babilon back.
57 I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow.
Dem go sleep and dem nor go wake-up again.
Mi, wey bi God, don tok.
I bi di Oga God wey dey mighty.
58 Dem go distroy Babilon strong wall
kon burn dia big-big gate.
Evritin wey Babilon build,
go skata go like dat.”
59 Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah. 60 Evritin about di distroshon wey go happen to Babilon pipol and some oda tins about Babilon, I rite dem down for book. 61 Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu. 62 Den make yu pray sey, ‘Oga God! Yu don sey Yu go distroy dis place and pipol or animals nor go stay der again and e go dey empty forever.’ 63 Seraya, wen yu don read dis book finish for di pipol, tie am for stone and trow am inside Eufrates River kon 64 sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ”
Na here Jeremaya message for finish.