6
Enemies For Jerusalem
Benjamin pipol, make una run for una life!
Make una run komot from Jerusalem!
Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem,
bikos wahala and distroshon dey kom from nort.
I go distroy Zion,
even doh e fine well-well and honbol like yong woman.
Difren kings go kom attack am with dia sojas.
Dem go build dia tent round di town kon kamp for der.
Dem go sey, “Make una ready to attack Jerusalem!
Make una kom make wi go attack am for aftanoon.”
But leta dem go still sey, “E too late,
evening don rish and di evening shadow don dey long.
So, make una kom make wi go attack
kon distroy all en strong-strong building for nite.”
Dis na wetin Oga God wey dey mighty tok,
“Make una kut all di trees for Jerusalem trowey
kon build wall round am.
I must ponish dis town,
bikos opreshon full am.
Just as well dey bring fresh wota kom out,
na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out.
I dey hear war and distroshon nois for di town
kon si wound and sickness for evriwhere.
So Jerusalem pipol, make dis one bi warnin to una,
if not, I go forget una
kon make una land empty and nobody go fit stay der.”
Dis na wetin Oga God tell mi:
“Di pipol wey remain for Israel,
go bi like grape wey dem press well-well.
So make yu go shek di branches again
like sey na yu dey press di wine out.
Den, make yu save di ones
wey yu fit save naw wey time dey.”
10 So I ansa,
“If I go warn and tok to dem,
na who go gri listin?
Dia ear block, so dem nor go hear mi,
bikos God word dey make dem vex well-well
and dem nor like am at-all.
11 My Oga God, just as Yu dey vex for dem,
na so too I dey vex and I nor fit hide my vexnashon again.”
Den God sey,
“Di shidren wey dey play for di street
and di yong men wey gada togeda,
make yu pour my vexnashon for dia body.
Dem go seize and karry husband and wife go
and dem nor go even sorry for old pipol.
12 Dem go give dia house,
wifes and farms to anoda pesin.
I go ponish di pipol wey dey dis land.
13 Bikos both rish and poor pipol
dey make money with wayo.
Even profets and priests join dem
dey deceive pipol too.
14 Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin.
Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’
Wen dem know sey nor bi so e bi.
15 Shame dey katch dem
bikos of di wiked tins wey dem do?
No! Dem nor dey shame at-all.
Dem nor even sabi form sef!
So, dem go die just as odas die.
Dem go die finish,
afta I don ponish dem.”
Mi, wey bi God, don tok.
Israel Pipol Rijet God
16 God tell en pipol,
“Make una stop and look round.
Mi, wey bi God, don tok.
Ask for di old way wey bi God own
and make una follow am.”
But dem ansa, “Dat nor bi di way wey wi like to follow!”
17 Den God sey,
“I choose profets make dem guide
and warn una about di trumpet sound!”
But di pipol ansa, “Wi nor won hear anytin!”
18 So God sey,
“Make all di nashons hear mi!
Make una bi witness to wetin go happen to dis pipol.
19 Pipol for dis eart! Make una hear dis word:
‘I won bring wahala for dis pipol.
E go bi payment for dia wikedness,
bikos dem don rijet my law
and dem nor gri listin to wetin I tok.
20 Dia gift wey dem dey bring from Sheba
or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi.
I nor go fit asept dia ofrin again
and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’
21 So God sey, ‘I go send sojas kom distroy dem.
Papa, mama and shidren go die,
even friends and neighbours go die too.’
Wahala From Nort
22 “God sey, ‘Si, sojas dey kom from one land for nort;
one nashon wey dey far and dem dey ready to kom fight.
23 Dem karry bow and swod dey kom;
dem wiked well-well and dem nor dey sorry for pesin.
As dem dey ride dia horse,
e bi like sey na nois for sea and dem dey ready
to kom fight Jerusalem pipol.’ ”
24 I kry kon sey, “Wi don hear di news and fear dey katch us.
So naw, wi dey pass thru pain like woman wey won born.
25 So my pipol, make una nor go farm or travel go anywhere,
bikos di enemies dey der with dia swod
and dem dey kause wahala for evriwhere.”
26 I still sey, “My pipol!
Make una wear sak klot and roll for groun.
Make una kry well-well and mourn
like sey una only pikin just die.
Bikos very soon,
doz wiked sojas go kom distroy all of us.”
27 God tell mi,
“I don choose yu to test my pipol
like who dey test iron,
den yu go kom tell mi wetin dem bi like.”
28 I ansa,
“Dem bi sturbon and wiked pipol;
dia heart strong like bronze and iron.
Dem dey lie waka
and na so-so bad-bad tins dem dey do.”
29 Di judgement fire dey burn
and e go distroy many yuzles tins.
So e dey yuzles to dey try to klean my pipol,
bikos wiked pipol still dey among dem.
30 Dem go koll dem yuzles silva,
bikos mi wey bi God, don rijet dem.