17
Josef first-born, Manasseh, dem give en tribe some land too. Manasseh first-born Makir wey bi Gilead papa, dem gi-am land, bikos dem bi wariors. Dem give dem Gilead and Bashan. Di rest for Manasseh shidren, dem give dem land akordin to dia family plus Abiezer, Helek, Asriel, Shekem, Hefa and Shemida shidren. Dis na di boys wey Manasseh, Josef pikin born akordin to dia family.
Naw, Zelofehad wey bi Hefa son, wey bi Gilead son and na Manasseh pikin wey Makir born, nor get any boy pikin escept girls and dia names na: Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah. Di girls go meet Eleazar di priest, Joshua wey bi Nun pikin and di leaders kon sey, “God tell Moses sey make e give us land among awa pipol.” So, Joshua give dem land among dia papa brodas, just as God kommand. Dem give Manasseh ten share for di land join di ones wey e get for Gilead and Bashan wey dey Jordan River east and dem give Manasseh dotas some land among dia brodas. Di rest for Manasseh shidren, na dem get di lands for Gilead.
Manasseh borda na from Asher go Mikmetat wey dey near Shekem. From der, e from sout face doz wey dey stay Tappuah. (Na Manasseh get di land dem wey surround Tappuah, but Tappuah main town, na Efraim get am.) Di borda na from sout go Kanah Valley. Dem give Efraim pipol some town among Manasseh towns, but Manasseh borda na nort for di valley and e end for di sea. 10 Efraim aria na for sout, while Manasseh own na for nort. Di sea na Manasseh borda for west and dia aria tosh Asher for nort and Issakar for east.
11 Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.
12 But di men for Manasseh nor fit win dis towns and Kanaan pipol still dey di aria with dem. 13 So Israel pipol pawa kon strong well-well pass Kanaan pipol own for dat aria, so dem kon force Kanaan pipol to bi dia slave, but dem nor fit win dem finish.
14 Josef shidren kon tell Joshua, “Wetin make yu give us only one part for di land? Wi many well-well, bikos God don bless us.”
15 Joshua ansa dem, “If una many well-well and di kountries for hill too small for una, den make una go inside di forest kon klear Periz and Refah land for unasef.”
16 Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well.”
17 Joshua kon tell Josef family wey bi Efraim and Manasseh sey: “Una get many pipol and betta sojas wey get pawa. Una go get pass one share. 18 Di whole kountry for di hill go bi una own; even doh na forest, una fit klear and take am. Una fit distroy Kanaan pipol for der, aldo dem get strong shariot well-well.”