3
Israel Cross Jordan River
As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river. Afta three days, di leaders bigin waka round di kamp kon kommand di pipol sey: “Wen una si Levi priest karry una Oga God box wey di kovenant dey inside, una must follow dem for back. But una go give dem gap wey rish 3,000 fit. Make una dey wosh, so dat una nor go dey klose to di Kovenant Box. Na dem go show una road, bikos una neva travel pass der before.”
Joshua tell di pipol, “Make una go klean unasef, bikos for dis time tumoro, God go do strong mirakle among una.”
Joshua tell di priest, “Make una karry di Kovenant Box dey go for di pipol front.” So dem karry di Kovenant Box kon dey go for di pipol front.
God tell Joshua, “From today go, I go start to honor yu among Israel pipol, so dat dem go know sey I dey with yu, just as I dey with Moses. Tell di priests sey make dem karry di Kovenant Box and wen dem don rish di wotaside for Jordan River, make dem waka enter di wota small.”
Joshua tell Israel pipol, “Make una listin to wetin di Oga una God dey tok!” 10 Joshua sey, “Na like dis una go take know sey, God wey nor dey die dey with una and E go really porshu Kanaan, Hit, Hiv, Periz, Girgash, Amor and Jebus pipol komot for una. 11 Si! Di Kovenant Box wey bi di Oga God for di whole eart own, don dey ready to enter Jordan River before una. 12 Naw, make una choose twelf men from di tribes for Israel, one pesin from each tribe. 13 Di priests wey karry God wey dey rule di whole world Kovenant Box, as dia leg tosh di wota for Jordan River, dat place go divide for una.”
14 So di pipol leave dia kamp kon waka dey go cross di river and di priests wey karry di Kovenant Box dey waka for dia front. 15 Wen doz wey karry di Kovenant Box rish di river kon enter di wota (Jordan River dey rush well-well, bikos na harvest time dem dey), 16 di wota wey dey rush, just stop. E gada go up for one town wey dem dey koll Adam (Adam dey near Zaretan) and no wota rush kom from der again go rish Arabah Sea (Di Salt Sea). Di pipol cross di river wey face Jeriko. 17 For Jordan River centre, di priests wey karry di Kovenant Box, stand well for dry groun. All di pipol for Israel cross pass for dry groun until evribody for di kountry cross finish.