5
Wen Amor pipol kings for Jordan River west and Kanaan kings wey dey near di wotaside for Jordan River hear how God take dry Jordan River for Israel pipol make dem waka pass, dem kon bigin fear well-well.
New Generashon
For dat time, God kon tell Joshua, “Make yu use stone take make knife kon sekonsaiz Israel pipol again.” So Joshua make di knife kon sekonsaiz dem for where dem dey koll Sekonsishon Hill.
Joshua sekonsaiz dem, bikos all di men wey old rish to fight wen den komot from Egypt, don die for di desert. Naw, doz wey dem sekonsaiz, na shidren wey dem born for di desert afta dem komot from Egypt and dem neva sekonsaiz at-all. True-true, na forty years Israel pipol take travel pass di desert, so all di men wey dey fight wen dem komot from Egypt don die finish for di desert, bikos dem disobey God and God don swear sey as dem disobey am, E nor go let dem si di land wey E don promise to give dem; di land where milk and honey full. God replace dem with dia sons wey Joshua sekonsaiz. Dem neva sekonsaiz dem before; dia papa nor fit sekonsaiz dem for road. Wen dem don sekonsaiz all of dem, dem kon stay di kamp until dia body dey okay.
God tell Joshua, “Today, di disgrace wey una karry kom from Egypt, I don remove am from una head.” So na Gilgal dem dey koll dat place kon rish today.
10 Israel pipol stay for Gilgal and dem celebrate di Passova for Jeriko field for evening for di fourteent day for di mont. 11 Di day afta di Passova, Israel pipol chop some food wey grow for di land, plus bread wey nor get yist and rice wey dem roast. 12 From di day wey dem chop di food wey grow for di land, manna kon stop to fall. So, Israel pipol nor chop manna again.
Israel Win Jeriko
13 Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”
14 Di man ansa, “Na mi bi di oga among God sojas for heaven. Naw I don kom!” Joshua fall face groun kon sey, “Wetin my oga won tell en savant?”
15 Di oga among God sojas for heaven kon tell Joshua, “Make yu pul yor sandals, bikos di place wey yu stand put so, dey holy.” So Joshua do as di man kommand am.