16
Ahaz Rule Judah Pipol
For seventeen years wey Remalaya pikin, Pekah dey rule, Jotam pikin, Ahaz kon bi king for Judah. Ahaz na twenty years wen e stay to rule and e rule from Jerusalem for sixteen years. E nor gri obey God, just as en grand-grand papa David obey. E dey do like odas wey rule Israel before am. E even burn en pikin as ofrin and dis na one bad sin wey di kountries wey God porshu komot for der, dey do. Di king dey offa sakrifice and burn incense for juju altar, on-top hills and under evry green tree.
For dat time, King Rezin for Siria and Remalaya pikin, King Pekah for Israel kon attack Jerusalem. Dem fight King Ahaz, but dem nor fit konker am. (Dat time King Rezin for Siria still attack Elat; e drive Judah pipol komot from der. Siria pipol kon go Elat and na dem dey stay der till today.)
King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.” Den King Ahaz take silva and gold wey dey God Temple and di palis go give Assyria king. Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.
10 Wen King Ahaz go Damaskus go meet King Tiglat-Pileser for Assyria, e kon si dia juju altar wey dey der. Den King Ahaz draw as di altar bi for paper kon send am go give Uriaya wey bi di priest. 11 Uriaya build one altar akordin to wetin dey di paper wey di king send kon gi-am from Damaskus.
12 Wen di king si di altar afta e don kom back from Damaskus, e kon go offa sakrifice for der. 13 E offa burnt sakrifice and korn ofrin. E pour en drink ofrin kon sprinkol blood for di altar as peace ofrin. 14 E take di bronze altar wey dey God present from di temple front (between di altar and God Temple) kon put am for di nort side for di new altar.
15 King Ahaz orda Uriaya kon tell am, “Make yu offa di morning sakrifice for di big altar, plus di evening ofrin, di royal burnt sakrifice, di food ofrin, di burnt sakrifice for Israel pipol, dia food sakrifice and evry oda sakrifice. Na only mi go dey use dis bronze altar.” 16 So Uriaya do as King Ahaz kommand am.
17 King Ahaz kut di stand komot kon remove di basin from dem. E take “Di Sea” from di bull wey dem make with bronze and wey dey support am kon put am for groun. 18 Di roof wey dem build for di temple and for di door-mot where di king dey pass enter inside for Sabat Day, e remove am too. E take dem komot, bikos e wont make Assyria king, happy.
19 Di remainin tins wey Ahaz do, plus all wetin e get, dem rite am put for Judah kings history book. 20 King Ahaz kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.