25
Dem Distroy Jerusalem
For di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon go fight Jerusalem. E build kamp round di town. En and en men dey der for two years and dat na di elevent year wen King Zedekaya dey rule. For di ninet day for di fourt mont for di same year wen honga for di town don strong well-well and all dia food don finish, di enemies break enter di town and all Israel sojas kon dey find where dem go run go. Dem run komot from di town for nite. Dem pass di gate wey dey di two wall for di king gardin, bikos Babilon men dey evriwhere for di town. So dem kon run dey go Jordan River Valley. But Babilon sojas porshu di king, katch am for Jeriko field and all en sojas run leave am. Dem katch di king kon karry am go meet King Nebukadnezzar for Riblah, where e for judge en matter. Dem kill all Zedekaya sons for Zedekaya present. So Babilon king sey make dem pul Zedekaya eyes komot kon shain am with bronze shain, den karry am go Babilon.
King Nebukadnezzar Distroy Jerusalem Finish
For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem. E burn God Temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. 10 Babilon sojas wey kom with di soja oga kon distroy all di wall for Jerusalem. 11 Nebuzaradan karry all di remainin pipol wey dey di town and doz for wildaness wey run from King Nebukadnezzar, plus evry oda pesin go Babilon. 12 But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.
13 Babilon sojas break di two bronze pila wey dey God Temple, plus di stand wey dem dey move and di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” Dem karry di bronze dem go Babilon. 14 Dem still karry di pots, shovels, trimmin shear, pans and all di tins wey dem make with bronze wey di priest dey use. 15 Di sojas oga take all di gold and silva tins with di basins and di tin wey dem dey use burn incense.
16 Di bronze tins wey King Solomon make for God Temple, plus di two pila, di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea,” di twelf bronze bull under “Di Sea” and di stand wey dem dey move, dey too heavy to karry. 17 Each of di pilas high rish twenty-seven fit. Di bronze top for one pila high rish four and half fit and dem dekorate di bronze with pomegranate fruit. Na so too dem dekorate di sekond pila.
18 Nebuzaradan katch Priest Seraya, Zefanaya di sekond priest and di three pipol wey dey guide di gate, den e karry dem go as prisonas. 19 From di town, e still take one among di sojas offisa, five pipol from di king adviser wey dem si for di town, one seketry among di sojas wey dey train pipol as sojas and sixty pipol from di land wey dem seize. 20 Nebuzaradan karry dem go meet King Nebukadnezzar for Riblah. 21 King Nebukadnezzar sey make dem kill all of dem for Riblah wey dey near Hamat. Na so dem take karry Judah pipol komot from dia land.
Govnor Gedalaya
22 Naw, King Nebukadnezzar for Babilon kon make Gedalaya wey bi Ahikam pikin and Shafan grand-pikin, govnor ova Judah pipol wey dey en land. 23 All di offisa for Judah sojas and dia men hear sey Babilon king don make Gedalaya govnor for Judah. So dem kon go meet Gedalaya for Mizpa. Di ofisas wey kom na, Netanaya pikin, Ishmael; Kareah pikin, Johanan; Tanhumet pikin, Seraya and Maakat pikin, Jaazanaya. 24 Gedalaya kon promise sey e go save dem and dia men. E sey, “Make una nor fear to work with Babilon sojas. Make una stay for di land kon surenda to King Nebukadnezzar, den evritin go dey well.”
25 But for di sevent mont, Ishmael wey bi Netanaya pikin and Elishama grand-pikin wey dey join di royal family, kom with ten of en men kon kill Gedalaya, plus all di Judah and Babilon pipol wey dey with am for Mizpa. 26 Den all di pipol, from small go rish di ones wey old kon run komot di town go Egypt, bikos dem dey fear wetin King Nebukadnezzar go do dem.
Jehoiashin For Babilon
27 For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison. 28 E sorry and trit King Jehoiashin well kon gi-am house wey betta pass where all di oda kings for Babilon dey stay. 29 E give King Jehoiashin new klot and King Jehoiashin kon dey chop evriday for di king tabol, 30 so King Evil-Merodak dey give Jehoiashin evritin wey e wont until Jehoiashin die.