2
Di Priest Message
Oga God tell di priests, “Dis kommand na for una: Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi. I go ponish una shidren-shidren and di animals wey una dey sakrifice, I go rub una face for dia shit and dem go karry una komot for my present. Den, una go know sey na mi give una dis kommandment, so dat di kovenant wey I make with Levi shidren wey bi my priests, go kontinue. Di rizin why I make kovenant with dem, na to give dem life and peace and dat na wetin I give dem, so dat dem go respet mi and dat time, dem really respet and fear mi. Instead of dem to dey tink bad tins, dem dey tink about wetin dey good and peace dey between us, bikos dem nor only dey do wetin dey good, but dem help many pipol, stop to sin. Na priest work to tish di trut about God. So make pipol go meet and learn wetin I wont from dem, bikos na Oga God send dem. But una wey bi priest don turn komot from di korrect road. Wetin una dey tish naw, don make many pipol dey sin. Una don break di kovenant wey I make with una. So, I go make di pipol hate una well-well, bikos una nor dey do wetin I tell una and wen una dey tish my pipol, una nor dey trit evribody ekwol.”
Di Pipol Sin
10 Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem? 11 Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju. 12 Doz wey do dis kind tin, make God wey get pawa remove dem komot from Israel kommunity and make E nor ever let dem join again for di sakrifice wey awa pipol dey bring kom gi-am.
13 Dis na anoda tin wey una dey do: Una go kry until una tear go full God altar, bikos E nor asept di sakrifice wey una bring kon gi-am. 14 Una dey ask, “Why E nor gri asept awa sakrifice again?” Na bikos E know sey una don break di promise wey una make with di wife wey una marry wen una yong. Na una patina e bi, but naw, una don break di promise, even doh una promise for God present sey una go dey faithful to am. 15 God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife. 16 Oga God sey, “I hate divorce. I hate wen one pesin among una do dat kind wiked tin against en wife. Make una make sure sey, una nor break di promise wey sey una go always dey faithful to una wife.”
17 Una don make God taya with una many tok. But una still dey ask, “How wi take make God taya?” Na wen una sey, “Pipol wey dey do bad tins, dey good for Oga God eye and E like dem well-well and wen una still ask sey, ‘Where di God wey dey judge well?’ ”