2
God Go Distroy Nineveh
Nineveh pipol, somebody dey kom
attack and skata una land.
So, make una guide una town well-well
and wosh una road too!
Make una dey strong and ready to fight!
Judah and Israel pipol bi like tree
wey en enemies break en branches,
but Oga God go make dem grow again
kon give dem glory and pawa.
Na red dem take paint una enemies shield!
Naw, make una si di red klot wey di sojas wear!
Make una si as dia shariot dey run togeda
and spear dey di sojas hand.
Di shariot dey run anyhow for di street.
Dem bi like tonda lite
and dem dey run fast-fast like lite wey flash pass.
Di king shaut koll en ofisas;
dem dey run fall as dem dey rush go guide di town.
Dem don skata and open di river gate!
Di palis go soon fall!
Dem don disgrace and karry Nineveh pipol
go anoda land.
Dem don drag dia kween go.
En girls savant dey mourn for am;
dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
Nineveh town full with pipol before,
but naw, all di pipol don run komot.
Even wen somebody shaut,
“Make una stop! Make una nor run!”
But nobody gri listin to am.
So naw, make una pak dia silva and gold,
bikos Nineveh propaty many well-well!
Nobody fit kount di money wey dem get.
10 Na wons dem tif and empty evritin for di town
kon turn am to where dem dey trow dirty put.
Dia heart melt and dia leg kon dey shake.
Honga won kill pipol and pipol face
don dey shange kolour!
11 So wetin don happen to Nineveh,
dat great town?
Dat place where lion full?
Just as lion and en shidren nor dey fear to waka,
na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.
12 Di lion dey kill wetin e katch
kon tear dem to pieces for en wife and shidren.
Na flesh full di lion house.
13 But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey,
“Nineveh pipol, I bi una enemy!
I go burn una shariot
kon kill una yong men for war.
Evritin wey una take from oda nashons,
I go take dem from una hand
and nobody go hear una messenjas vois again.”