3
Christ Go Soon Kom
My friends, dis na di sekond leta wey I dey rite to una, so dat una go dey tink about di tins wey I tell una. I wont make una remember all di word wey di profets tok before and di kommandment wey awa Oga God and Savior give us thru di apostles. Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem. Dem go sey, “I tink sey Jesus promise sey E go kom back? Awa grand-grand papa dem don die since, but evritin still bi as dem bi since God kreate di world.” Dem don forget sey, na with word God take kreate di heaven before E kreate di eart from wota and na with wota, E take make dis world. And na with di same wota, E take distroy di eart wey dey before. Na di same word God take keep dis heaven and eart dey wait for fire wey go kom. E keep dem dey wait Judgement day. Di day wen E go distroy di pipol wey nor dey fear am.
Naw, my friends, make una nor let dis tin pass una, bikos one day bi like 1,000 years for God eye and 1,000 years bi like one day. Nor bi sey God nor fit do wetin E promise as some pipol dey tink, but E dey patient dey wait for una, bikos E nor wont make anybody die trowey, but E wont make evribody turn from sin kom meet am. 10 Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish. 11 Since evritin go melt like dis, wish kind pipol wi suppose to bi? E good make wi dey live awa life for holiness and dey do wetin God wont. 12 Since wi dey wait for di day wey Christ go kom, make wi dey do wetin wi fit do to make Christ kwik kom. Bikos for dat day, evritin wey dey for heaven go burn kon skata and di stars, go melt. 13 But as God promise, wi dey wait for di new heaven and eart, di place where raitiousness dey.
Di Pipol Wey Get Faith
14 So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom. 15 God dey wait with patient, so dat una go turn from sin kom meet am, just as awa broda Paul rite give una akordin to di wisdom wey God gi-am. 16 E tok about dis tins for all en letas. Aldo some tins for di leta dey hard to undastand and doz wey nor know di trut or dey stabol, don turn dem to wetin go kill dem. Na so dem take distroy all di oda part for God word too. 17 So, my friends, as una don know wetin go happen, make una shine una eye, so dat una nor go miss di way and fall from di trut wey una get, bikos na so pipol wey nor sirious, dey do. 18 But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.