129
Prayer Against Israel Enemies
Solomon Song
1 Make Israel pipol sey,
“Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.
2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw,
dem neva ever fit win us.
3 Dem don use cutlass kut all awa back
like sey na farmer klear am.
4 But God dey good;
E don kut di rope wey wiked pipol take tie us and naw,
wi don dey free.
5 So, make evribody wey hate Jerusalem,
turn back with shame.
6 Make dem dey yuzles like grass wey dey on-top roof,
wey go die as e dey grow
7 and pipol nor go plok or si am again.
8 Yes! Pipol wey dey waka pass nor go sey,
‘Make Oga God bless dem’ or sey,
‘Wi bless una with Oga God name.’ ”