53
Men Wikedness
David Song For Di Kwayamasta
1 Na fools dey tok for dia heart sey,
“God nor dey.”
Dem don spoil;
na bad tins dem dey do
and e nor get any one among dem wey dey do good!
2 God dey from heaven look evribody;
E dey look to si if anybody really get sense
and weda anybody really dey find am.
3 But nor bi so. Evribody don dey sin;
evribody don spoil finish.
E nor get anybody wey dey do good at-all!
4 Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all?
Dem dey chop my pipol like bread
and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.
5 Fear go katch dem
and na di kind fear wey dem neva si or hear before.
God go skata yor enemies bones.
God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
6 Na who go kom from Mount Zion
kon save Israel pipol?
Wen God don save en pipol, den
Jakob shidren go shaut with joy
and Israel pipol go happy well-well.