70
Prayer For Help
David Song For Di Kwayamasta
My God, make Yu kwik kom save mi!
Hurry kom help mi!
Make shame and disgrace follow pipol
wey won kill mi!
Pipol wey dey laf dey sey, “Aha! Aha!”
Make Yu porshu dem go back kon disgrace dem!
All di pipol wey dey find Yu,
make dem dey happy with joy, bikos of Yu!
Pipol wey love to si sey Yu diliver dem, make dem always dey sey,
“Make all di praiz bi God own!”
Dem don opress mi and I nor get anytin! Abeg my God,
make Yu kwik kom save mi,
bikos na Yu bi my helpa and di Pesin wey dey diliver mi!
So make Yu kwik kom!