28
King Ahaz Rule
Ahaz na twenty years wen e start to rule and e rule for sixteen years from Jerusalem. E nor do wetin God wont or follow en grand-grand papa David footstep. Israel kings wey make Baal juju before, na dia footsteps e follow. E use en sons take do sakrifice for Ben-Hinnom Valley and na dis kind sins di nashons wey dey der before, dey do wey make God drive dem komot di land. E dey offa sakrifice and burn incense for where dem for dey woship juju on-top di hill and for under evry green tree.
Di Oga wey bi en God kon gi-am to Siria king. Siria pipol win and karry Judah pipol go Damaskus as prisonas.
God still gi-am to Israel king and e kon distroy en kingdom. King Pekah for Israel wey Remalaya born, kill 120,000 sojas for Judah, bikos dem turn from dia grand-grand papa God. One soja for Efraim wey dem dey koll Zikri, kill di king son wey dem dey koll Maaseaya and Azrikam wey dey kare for di palis with Elkanah wey bi di kommander. Israel pipol seize 200,000 wifes, sons and dotas from dia brodas. Dem still karry many of dia tins go Samaria.
Oded wey bi God profet, dey der. E go meet di sojas wen dem rish Samaria kon sey, “Si, bikos una grand-grand papa God dey vex with Judah pipol, na-im make am give dem to una. Una don kill dem well-well and God know evritin. 10 But naw, una won turn Judah and Jerusalem pipol to una slave. Una nor know sey dat one na sin against God? 11 Make una listin and send di pipol wey una katch from una brodas land go back, bikos God don dey vex for una!”
12 Zabud wey bi Jehohanan pikin, Berekaya wey Meshillemot born, Jehizkaya wey bi Shallum pikin and Amasa wey Hadlai born kon go meet doz pipol wey dey kom back from war 13 sey, “Make una nor bring doz slave kom here! Una wont make us kommit more sin for God eye? Awa sin don plenty rish and God don dey vex for Israel pipol already.”
14 So for di ofisas and di pipol front, di sojas kon release di slave and all di tins wey dem karry. 15 Dem tell some men make dem find klot from di tins wey dem karry kon give di prisonas wey naked. So dem give dem klot, shoe, food, drink and oil wey dem go take rub dia body. Di ones wey nor fit waka, dem put dem on-top donkey. Dem bring dem back to Jeriko, di Palm Tree Town, den dem kon go back to Samaria.
16 For dat time, King Ahaz kon ask Assyria king make e help am. 17 Edom pipol don fight, win and karry Judah pipol go as slave again. 18 For dis time, Filistia pipol don still go fight Judah towns for di low lands and Negev Valley. Dem take-ova Bet-Shemesh, Aijalon, Gederot and Soko, Timnah, Gimzo and all di towns wey near dem kon stay der. 19 God sofa Judah pipol, bikos of King Ahaz for Israel wey enkourage Judah pipol to sin and disobey God. 20 King Tilgat-Pilneser for Assyria kom, but instead make e support, e kon give dem more trobol. 21 Ahaz gada many tins from God Temple, di palis and di ofisas kon give dem to Assyria, but dat one nor help am.
22 Na wen King Ahaz dey for trobol, e even disobey God pass. 23 E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.
24 Ahaz gada and remove all di tins wey dey God Temple. E lock di temple doors kon make juju altar for evry street for Jerusalem. 25 E make high place for evriwhere make dem dey give juju sakrifice for Judah. E make en grand-grand papa God vex well-well.
26 Di remainin tins wey Ahaz do wen e dey rule, dem rite dem for Judah and Israel kings history book. 27 Ahaz die and dem beri am for David Town, but dem nor beri am for where dem beri Israel kings put. En pikin Hezekaya kon take-ova as king.