30
Di Passova
King Hezekaya send message go Israel and Judah kon rite leta go give Efraim and Manasseh pipol sey make dem kom God Temple for Jerusalem kon celebrate di Passova to take honor di Oga wey bi Israel pipol God. Di king, en ofisas and Jerusalem pipol kon choose to do di Passova for di sekond mont. Dem nor fit dey do am always, bikos many of di priest neva fit santify diasef and di pipol neva gada for Jerusalem. Di king and all di pipol like di plan. So, dem send message go evriwhere for Israel; from Beersheba go rish Dan kon koll all di pipol sey make dem kom do Israel pipol God, Passova Feast for Jerusalem, bikos dem neva koll all di nashon kon do am before, just as dem rite am for di law.
Di messenja give evribody for Israel and Judah, di king and di ofisas leta. Wetin di king rite for di leta na,
“My pipol Israel, make una turn back kom meet Abraham, Isaak and Israel God, so dat E go kom meet una wey E save from Assyria kings. Make una nor bi like una papa wey nor dey obey dia grand-grand papa God wey make am vex distroy dem and una know evritin. Make una nor dey sturbon like una papa, but make una obey God as una dey kom en house wey E don make holy forever. Make una serve am forever, so dat E nor go vex for una. If una turn back kom meet God, doz wey karry una relashon go prison, go pity and free dem. Di Oga una God dey sorry for pipol and if una turn back kom meet am, E nor go rijet una.”
10 Di messenja waka from one town to anoda and e go evriwhere for Efraim and Manasseh land, e even rish Zebulun, but di pipol kon dey laf am. 11 But some men from Asher, Manasseh and Zebulun honbol demsef kon go Jerusalem. 12 God still help di pipol kom togeda for Judah, bikos dem obey di king and en ofisas kommand.
13 Many pipol gada for Jerusalem for di sekond mont make dem celebrate di bread wey nor get yist feast. 14 Dem remove di juju and incense altars from Jerusalem kon trow dem for Kidron Valley.
15 Dem kill di Passova lamb for di fourteent day for di sekond mont. Di priest and Levi pipol kon dey shame for diasef, so dem go God Temple go klean demsef kon offa burnt ofrin. 16 Dem stand for dia difren pozishon, just as God savant Moses rite for en law. As Levi pipol give di blood to di priests, dem kon sprinkol am for di temple. 17 Many pipol wey gada neva santify demsef, so Levi pipol kill di Passova lamb for all di pipol wey nor dey klean and wey nor fit make holy sakrifice for God. 18 Many pipol wey kom from Efraim, Manasseh, Issakar and Zebulun nor dey klean, but dem still disobey kon chop di Passova food as di law tok. King Hezekaya kon pray for dem sey, “Make Oga God wey dey good, forgive 19 evribody wey won follow God wey bi en grand-grand papa God, even doh dem nor dey klean as dem rite am for di temple law.” 20 God hear King Hezekaya prayer kon forgive di pipol.
21 Israel pipol wey gada for Jerusalem celebrate di bread wey nor get yist feast for seven days with joy. Di priests and Levi pipol dey praiz God evriday with all dia heart.
22 King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.
23 Di pipol kon sey make dem celebrate for anoda seven days, so dem kon celebrate for anoda seven days. 24 King Hezekaya give di pipol 1,000 bulls and 7,000 sheep. Di ofisas still give dem 1,000 bulls and 10,000 sheep. Many priest santify diasef too. 25 All di pipol wey gada for der na: Judah pipol, di priests, Levi pipol and strenjas wey dey stay Israel and Judah land. 26 Di party for Jerusalem big pass anytin wey don happen for Jerusalem, since wen Solomon wey bi David pikin, bi king. 27 Di priest and Levi pipol stand up kon bless di pipol and God ansa dia prayers from en throne for heaven.